Hello my country people, how ona dey?
The killings for the country now, election self matter so 🙄
What Do you think about the 2023 Presidential elections?
It should be cancelled, who dey with me?
Make all of us rule each other, share the country money, burn aso rock down then live as many Nigerians (nor be only one Nigeria 😏)
Election that people are not even safe to give the vote that they will still rig and put who they want there 😑 this country is messed up in that aspect abeg.
Have you gotten Your PVC?
Not yet and honestly, no reason because I'm super lazy to do so. Like what a friend of mine said, I nor go vote with am if elderly person nor follow me 😂 I nor wan die for person matter nau.
Maybe if it was an online thing, the election for sweet 😏 well sha, let's see how it goes.
Who are you voting for and why?
Myself, who go vote for me? 😅 But that na if you nor agree with wetin I first talk sha, make them cancel the elections ooooo 😂
I'm just looking at those people that wants to vote for Atiku, normally the man suppose don dey care house (E don too old nau) 😂 Abi we wan repeat wetin happen for Burahi regime wen he nor even know wetin dey happen for our country? 🤦♀️
We no fit rule each other for here oo. That's even when the matter go even worse pass. Even with leaders we no get ourself shey na when we no get at all things go soft.
The issue is our leaders have forgotten the true meaning of leadership. Leadership is service not the other way round.
😂😂😂😂😂😂😂
I don talk my own, make Nigeria go e own, make Nigerians go their own 🤣
Make we just dey like that, na the same thing
🤣🤣🤣 so if Nigeria go en own which nationality you go con be? Anonymous or 'I prefer not to say' abi😜🤣
I prefer not to say 😂
Mama don vex.. Chop knuckle jare
😂😂😂😂😂