Hello Steemians, I don bring something wey concern us in our everyday waka.
Make we yarn small about ATTITUDE.
Wertin be Attitude? Oga Keith Harrell talk say, "Attitude Is Everything". Him also say, ''A Positive Attitude is the greatest asset you can possess in life". My brothers and sisters make we kukuma yarn ways wey person fit behave for him organization.
ATTITUDE AT HOME: As pale and male wey you be, how you dey behave for house make your pikin see? Pale you dey beat your wife for your pikin face? Male you dey abuse your husband too? Make una reason say una pikin dey see all the yeye behaviours una dey show case, him don stick am to him brain and him go follow do am wen him big.
ATTITUDE IN THE CHURCH: Sisters and brothers in the Lord. How you dey treat person for your church? You catch hunku Ben with hanti Alice for outside church wey waka hold hands together, you come broadcast am for church. You tell one person, say make the person no tell another person. Before you sabi wertin dey happen, hunku Ben and hanti Alice don enter black book.
Brother, sister abeg repent. No use your mouth destroy people for church if not church go close.
Photo source: Internet
ATTITUDE IN WORKING PLACE: Oga madam, how you dey treat your workers? Workers, how you dey relate with your fellow workers? You sabi say the time you dey use do eye service for your oga, dey report your fellow workers give am, you fit put in that same time and energy do something meaningful.
Photo source: Internet
Make I conclude by saying, attitude na person signature. E no fit transfer by blood from person to person. Chose positive attitude today so e go better your life tomorrow.
I stand up for POSITIVE ATTITUDE!
Attitude... D sole ingredient of one's social life
Exactly dr
I stand for positive attitude.
Very important to.
Five star for you