My countri people!
How Una dey hold body..
Naijapidgin don carry another tori come una domot today.
Bad things dey happen for dis naija wey we dey.
E get one woman, her name na Charity Chidiebere Aiyedogbon for Abuja wey lost for 2016, e family people find am, dey no see am, police people come join dem dey find am but the come see some body parts wey dem package for sack bag put am for water wey dey Ushafa, Bwari area for Abuja. The woman even get 4 pikin but she no dey marry her husband again, dem divorce.
Police people don dey find the suspect, Paul Ezeugo since May 2016 but dem finally catch am. The guy dey design website sef. E come be say Paul and the woman bin meet for facebook come dey date that year. Paul come dey feel say e no dey get money for the relationship even though the woman no too get money like dat. Paul come dey eye the woman Acura ZDX SUV, e go call e friend Emmanuel Adogah, dem 2 kill the woman carry her SUV and other things wey dey fit carry. The guy cary the women, give am plenty alcohol, come carry am from Yaoundé Street to Kagini area, na that place wey e come cut am like meat put am fro sack go dump am for the water wey dey for Ushafa for Bwari Area for May 9, 2016.
Wetin dey sweet me for body be say d police people no give up at all. Na dis kind Police we need for this countri, Police wey sabi their work. Dem don dey find these people since 2016 and dem no rest till dem succeed. Paul come dey talk say na devil push am to kill the woman. So as the woman no dey give am wetin e want, devil come tell am make e kill am. This world dey evil o, no be everybody wey dey waka for road be human being.
Make una chook mouth for this matter..
Wetin una think for this kind thing wey dey happen?
The Police people try? Make una hail them for comment
Footnote
**If you would like to support us,
Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.
We are naijapidgin community with a mission to promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows
Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.
On discord we have the following shows and lectures:
[Tuesdays by 8pm]Real-Life Talk with @preciousimoLectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]
Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]
Steemit Diary + Amebo with @rebeccafl [Fridays by 8pm]
Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]
Special Hotseat [Sundays 8pm]
Dont miss it
Naijapodgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner @zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing
Na @nmalove bring dis tori
Na @mittymartz design this avatar
Hmmmm. So unfortunate indeed.
Kudos to those police dem.
Yes o kuddos to dem
Lol na devil indeed. Na so dem dey always talk. E good for them. But i think say na just one man commit the crime? How they come dey two for the picture wey u put?
No be only one man o nah em and em friend do am
I hail una @naijapidgin. Kudos to NPF for the better work wey dem do to catch these criminals.
E dey easy to blame devil for our mistakes when we get power of choice. Watin Dey vex me be say dis guy use him mouth talk sey the woman dey give am everything him want. MA greed push am to butcher him fellow human being like animal.
God go save us from this kind yama-yama people
My person devil don suffer o
What a beast, there is nothing people won't do for money sha, kill im fellow human cos of SUV. Lazy youth...
My brother nah so we see am o
People wicked !
No be lie o
Thank God for the kind heart the police get, for Nigeria,the law be say,if you kill dem go kill you too. So my judgement be say make dem sue am to court,judge am kon sentence am to death by hanging
Hmmmm