My Egusi/Okro Soup

in Hive Food2 years ago

Make I no lie, I never try this one before. As hunger wire me this morning, Na so I look my pocket, I con realise say SAPA No good ooo and the thing hold me badly.

So I enter market, buy stock fish, crayfish, kpomo, fresh pepper, egusi and other small small mede mede.

Na when I reach house, I con see say my okro sef don mature Wella and e don ripe reach to talk cook beta okro soup weh go enter the body wella.

No be small tin ooo, Na so idea enter my head and as a sharp Igbo boy, I no fit con carry last. I say make I cook egusi and okro soup then use better fufu swallow am. But before I start cooking, I say make God help me😅😂🤣.

Ingredients and list of things for my food:

stockfish,

crayfish,

kpomo,

fresh pepper,

egusi

Okro

Fufu

Abeg no laugh me. I use beg name take God una. 😂🤣

Sort:  

😋😋😋 feel like eat up all of this right