You are viewing a single comment's thread from:

RE: Hive-Naija Weekend Engagement #48 - "Food"

in Speak Peace2 years ago

Guy, you mama /sister bin dey try abeg, pounded yam everyday? I dey imagine am, my hubby set like pounded yam but as city wife way I be, no power to pound, na the day him mind sweet am, e go do the pounding, while I do the cooking and then satisfy his pounded yam cravings.

Lagos dey limit person natural lifestyle too much.

Sort:  

Lol, na village life deh make person pound every day.
Who get the time for lagos to deh do that?
So u deh form lagos babe for your hubby nawa o.
So na fufu u deh settle for now like me??

Yes O, pounded yam na work, and no time, hustle don take over

Lol, but u like to eat pounded yam abi

Yes O, when I see, who no like better thing

Hahaha I see ,thank u for stopping by.
How's the weekend?

Stressful O, just catching cruise online now

It's ur season now, so as money deh enter deh chill on hive for night