You are viewing a single comment's thread from:

RE: Hive-Naija Weekend Engagement #48 - "Food"

in Speak Peace β€’ 2 years ago

Omg as a foodie I can't skip this ..πŸ’ƒ

As a typical nija babe I no know if ah get favourite food oo.becuse anything way concern food I dey .
But shall the food I fit eat like 5times a day, no tire na spaghetti..
Whether white or jellof ooo. Any how you cook amπŸ˜„πŸ˜„.

Like e get one feeling of satisfaction e dey give me .
I ready to cook am morning afternoon night.
I pray make my future husband be the baby type o, because spaghetti has come to stay 🀣🀣. because how can someone not eat spag and plantain.

THE FOOD I DON'T LIKE .
okoro soup..I no know wetin okoro soup do me oo,but I no like am.
Although na vegetable but omg I hate that soup.
Because how soup go dey like catarrh, you go eat finish dey find chewing gum.
(I'm sorry to all okoro soup lovers for describing it this way.) Anyway why I really dislike am na be say I purge the first time I eat am.
I spent the whole day in the toilet.

I no know shall maybe na me never eat the one them wash hand make .🀣🀣🀣🀣
But till then I no want.!..

Thank you 😊.

Sort: Β 

Look at this old woman in a young girls Body Lol πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚...you no like okra soup ahhh Lol πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚, na that catarrh look dey gimme joy Lol πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚ I like food too oh Lol πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚...

Well you don see husband already because I like spaghetti too so no look far, I am here Lol πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

🀣🀣🀣🀣🀣
I deyy suspect this husband.
God abeg oo

Lol 🀣🀣🀣🀣 weytin you dey suspect Lol πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

Lemme not really firstπŸ˜„πŸ˜„

LOL 🀣🀣🀣 you don Carry loud lol 🀣🀣🀣