D day bin dey hot wela when my mama call my elder broda tell am say make him inform me make I turn come one school like DAT,say make I tell d bike man make him drop me for Methodist senior science college,
No ask me wey d school dey,I sabi wey e dey...loll
Ok! As I been d talk,na him I turn go oo
Ghen Ghen! My mother one comot me for my former school (one ajebo school like DAT) carry go science college, any way me I like science from start but I like art too,in fact, since na gist we dey gist,make I just tell u say I been register further mathematics for science but instead, na literature class I attend, so last last! I no write literature, I no write further mathematics, no worry,I go explain later.
If u for read my last post u for notice say I bin don already talk say I short,
Check my blog @sirmartinet for the post tag #hive naija contest
As I small reach na DAT time, walka enter d principal office na him d man tell my mother
"Ma'am, please you must understand that we don't offer admission into junior secondary classes"
My moda answer am but d answer no enter my ear, d only thing wey I dey think na whether na me wey don Go school reach jss 3 collect accolade join na him dis man d follow talk? Anyway, aw I go take blame am? Na my height do.
My pple, na so I get admission into d skull oo,d skul set shaa,but d lessons self no be even wetting I even remember for this contest,na wetting bin d happen for the boarding house,
As I enta, na him one fair bikini girl like DAT com ask if I go be her school sista,me shoo?
School sister nii! Any way, since u dey brilliant and u set well,no p!
E no even tay na him another one come,d same question, me am like, " na wetting children come school to come do be dis?" I no know say e go help me later.
Another thing wey I bin like about my friends back den be say dem be d try encourage person to read,we bin dey compete.
In fact, later in ss2, almost all of us were prefects, I was the senior time keeper,and later in ss3,doubled as d assistant dining prefect.
One day, na so I dey oo on my own wen my squad man (if u no bin go kpako boarding school, u no go know wetting squad man mean) carry all our nick names go stamp for dormitory wall,I bin too like my first name (martinet) so I doubled DAT as my guy name,na him d guy go write:
Atiza roboto
Ft
Maga daga
Ft
Sir martinet alias baby face
Ft
Super warrior
Ft
Kpong nkpo oró
Ft
Silent dissolver
Ft
LA Dainty
Ft
Agama lizard
My dear,all dis while, pple d stamp their name for wall oo,nothing happen oo,but DAT faithful day,na him compound master say him wan go do inspection, and na DAT day for d first time in my life,I receive 24 strokes of Cain,but my dear I no complain cos d others,na paint dem buy,
Unto say my name been get meaning and na English name,Na him them take spare me o,but shaa,d name still dey wall until now,those paints na teachers dem carry am share give make dem use paint their quarters.
Another thing wey I one talk about d skul na wetting we call canwee (refectory) hmm! There na survival of the fitest oo, if u no fit drag,just know say u don miss meal, DAT time wey I never collect post,na d girls bin d collect food for me unto say dem be my elder sisters for school and dem no bin want make I dey carry cooler run, if na DAT wan,I been d sabi, and if na other squad men share food, just know say no body d chop,so u go need go canwee early to go share food,after u don collect some florescence bulb for ur head,if u withstand, u go share,if u comot run,no p,another squad go share and u no go chop,but DAT one no mean say u go fight oo,if person win u him don win u,if u share u no give other squad men dem,know say when dem go share dem no go give ur squad.
After the normal night canwee, e get another extracurricular activity wey we call JUNCTION, there na wer boyfriends and girlfriends go meet for still DAT refectory, but if teacher come catch u, on your own (OYO). So na der at times I dey go meet those skul sisters of mine collect my food wey dem bin don commandeer for me.
Monday breakfast is always d worst breakfast, because na white pollo and maroon trousers we dey wear every Monday and na beans we dey chop as breakfast,so if u wan carry food run for cooler, na too scoop the beans spray for air, every body,
Even the strongest squad go run,and off u go.
My dear,I don talk too much,make I rest,
I still be @sirmartinet
Baba thank you for participating in the contest.
Me sef go boarding school. My own experience n too gel like that but we thank God say we finish sha.
Lolll
Baba na true say we don finish last last,thank u say u walka come reach my street
Lol.. aswear, no white man go fit read up to 5 lines of this post. Even me dey struggle understand some lines but man I salute your pidgin.
I no even understand weytin canwee mean. Anyway na the boyfriend and girlfriend junction I like pass, na that side I come dey laugh.
Anyway, he be like say you just join hive. So, welcome my brother I hope say you go enjoy your stay here.
Keep Hiving man.
Broda i salute u as u welcome me , as for white man to read pidgin, bro,make him follow feel aw e been dey us dat time them start to teach us english for school,lolll
@starstings01 na new i be o,so i for just like get any help wey dey
Canwee means refectory
And e also sweet me for belle as u take time take read am,thanks bro
Smile.. yeah naso brothers suppose do. Feel free to Waka come my page once a while man.
Funny you, as of the white man.
Congratulations @sirmartinet! You have completed the following achievement on the Hive blockchain and have been rewarded with new badge(s) :
You can view your badges on your board And compare to others on the Ranking
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word
STOP
To support your work, I also upvoted your post!
Support the HiveBuzz project. Vote for our proposal!