Hello my people...how una dey?
I just the come back from church now now self
And hunger the waya me but i go just drop my own funny story sha...
One day wey i just the come back from work, i say make i kuku ma trek comot road as i no see keke... As i dey go na him one man stop me say him the sell medicine wey dey cure rashes, ezyma and pimples, say if i rub am, 2days na him en give me say everything go clear sharp sharp....
Lol, i come laugh, i look myself as i fresh, no pimples, no rashes, no ezyma, i come look the man see how rashes full him face...na so i gently tell am say,
Bros abeg who the sell medicine for rashes and em sisters no the use am for himself?
I come tell am again say na him need the medicine pass no be me...na so i waka leave am there..
Make i go check my rice before the thing burn o 🏃♀🏃♀