I HAIL UNA NIGERIA POLITICIANS
Abegi na where snake set swallow money??
When dem sama me dis matter,I tink set na yawa o, na ein I cun see am with my koro koro eye for news e cun b like film. The tori ehn,e weak me enter my bone.
So I believe set dis snake go dey fresh for body now...As this matter dey go so,my mind dey tell me set na another embezzlement dem use knack us for face.
Our politicians dem,tiri gbosa for una,na don try for this snake matter, and dis snake wey dem dey talk so,I sure set na one person dem dey talk so...no b set na real snake..the tin wet I know say truth truth go soon come out,and we go catch dat snake wet swallow 36 millions... If dem no investigate this matter well well,maybe later na fowl,lizard,mosquito go dey swallow billions.
My country pipu,na God go save us oooo,since our Broda RAT don pursue our pressi bayii
I don drop my tori again..
#i still be una boi @badmusazeez
You are viewing a single comment's thread from:
Haha! I just dry wonder how mosquito go be if e swallow money.. Na so we see am for this country, anybody wey chop money go dey call animal, the thing tire me. One day we go hear the truth.