You are viewing a single comment's thread from:

RE: TRANSPORT MONEY PALAVA

in #naijapidgin7 years ago (edited)

I like dis mata wey una carry come by domot dis morning.
If dem say make I talk, woman no suppose go man house for the first time for any reason. D tin dry somehow.
Na d man suppose go d Girl house bcoz name him dey find something, maybe relationship.
I no fit allow my pikin go man house wey she no know, d tin dey somehow bring down the integrity of the girl, e fit make her look cheap and easy to get, as a woman she get her pride and the man must respect it.
If the man really want den, make him go the girl house. I Don hear enough story of how a girl wey go man house was raped and molested. It is very risky and dangerous, though not all men are dangerous but you never can tell.
If finally the girl atal atal come the man house, the man suppose give her transport, courtesy demands that, he no need wait for her to ask for money for transport. Na wetin dem dey take know a gentleman.