You are viewing a single comment's thread from:

RE: Snake wey go swallow millions. How una take see am?

in #naijapidgin7 years ago

Naija! Naija! Naija!

How many times wey I don call your name?

Why e come be say na only you wey go fall inside pit, leave climb-comot wey you suppose climb comot begin dey dig am with shovel? Choi, our mumu never do ooooo, e don dey multiply sef 🙆

Nigeria ooooo, so na here we don reach? Na so e go dey be? Snake don dey chop our money, rat dey chase our president, e remain make goat chop our Constitution na 🤷

Choi! Nigeria, we hail thee!

Sort:  

Brother wen budget go loss again them go say na goat chop

Useless set of people wae de power

The person wae anounce am no get small shame for body.... We Cary power give cow to rule us 🙈🙈🙈🙈🙈

I go finally comot d country

My broda, na so me dey wondero. Person wey dey announce am shame no dey catch am? D tin weak me for body.

My broda goat too big, e fit be cockroach. Hahaha!! Abeg make we ready our voters card, make we fit vote government wey go commot us for pit.