My people I greet una well well o
Na my entry be this:
This idea of people when dey ask question when Dem know the answer already who start am sef?
The other I just dey stroll for my street with my headset dey hear correct gbedu, naim one mumu when God go help me punish con see me dey ask me "afa that you cloth na red?" I con answer am "Nooo... na immaculate white, you fit even call am sky green" da wan commot another wan see me dey ask me "oboy na headset be that?" Trust me I nak am back "Nooo... Come on.... Na 4 plots of land be this now,..."