You are viewing a single comment's thread from:

RE: MONKEY BUSINESS

in #naijapidgin7 years ago

I greet all my country people wey dey dis community, how ur day take dey waka.

Monkey wey dey chop money.

For this our country, animal matter don tire me I swear, rat today snake tomorrow ,wetin we wan come do.
My country people 7 milla no be seresere money, how dem go come say monkey chop the money abi this our leaders don turn us to mumu ni.
Something is happening here right now, it be like say I go go enroll for animal kingdom bcos I don dey envy them like this, our nigeria wey be say ordinary rat don dey get relatives for Aso rock.

As I don dey observe this kind level, na confirm sh*t, wey be say our country don turn animal kingdom

Way forward.

Stoping our leaders wen don corrupt patapata from all dis childish tricky behavioursIMG_20180223_092602_376.jpg