Naija pidgin Alfa?
I throway salute give Una ooooo
Mehn I no fit lie you, my artist wey I fit kill person if I hear say she land my area na Yemi Alade.
My Koko reason wey I take gbadu this babe say she gather for every dormot.
Abi na voice? She gallant for that area, she dey strike pitch wey thunder no reach.
Abi na performance? Abeg make them clear road the babe get am. Once she handle mic, na so so shout dey full everywhere.
Abi na to dance?
Abi na fine?
Abi na shape?
The babe gather everything. She no dey form. She dey give us real groove, she sabi garnish her music with swaggs.
Abeg na my babe be this. I too love am.
Me I believe say when u like something wewel. You no go fit yarn why. Forget dat thing, the babe just gather for my side. To end the gist, she dey make me speechless. 😘