my pipu I greet una for the language wey una understand. How una dey? Hope say una dey kamkpe.
my pipu happy Sunday
the thing wey my pastor wey e name Na Pst.Dr.Timothy Adeniyi preach today Na my change will come.
the text Na from Job 14:15.
wetin I learn be say
change Na the only thing wey no fit change.
Na only our baba Goddey fit change the thing wey be change.
and for us to enjoy change we must do some kind things wey I list down as you the read
- You need Jesus
- You go also vex with the condition wey u dey now
- You go also change the way you dey think
- you no go give up
- Finally finally you go the pray well well.
my pipu for Naijapidgin Na here I pab break.
Nice
She na you get that car wae de your back 😂😂
Na me suppose get am but my friend Na e dey with d key