HOW PIKIN TAKE RAPE E PAPA

in #naijapidgin7 years ago


source

Naijapidgin Una weldone o
Today na Friday oo, I know say some of us don dey ready to flex, ah market don dey green small small, so to flex no go hard..

As e dey hot! naijapidgin don carry another matter come today, and this matter dey weak person ghan!

Omo this world don spoil finally sha, e get one man for Lagos wey dey 50 years old, the man go give e pikin wey dey 21 years old belle. The man dey carry the girl dey waka up and down like say e be e babe, they come dey do relationship. Casala burst for their head wen the girl carry belle, na e the man wan begin try kill himself. E first jump inside well, neighbors remove am, he try hang himself, people stop am, finally finally e wan drink insecticide make e die like mosquito but the neighbors stop am. Na e landlord wey e never pay carry am go police so that e go fit pay am as to die don dey hungry am. Na dere wey the man begin talk.

The thing wey weak me pass be say, the man talk say na e pikin rape am, plus devil wey put hand join for e life.. I tire, how pikin go rape e papa? I believe say man wey dey 50 years never too old, atleast e dey strong, so how the girl come rape am? Why e be say anytime wey person do bad thing e go dey call devil like say dem two dey live for house?

Abeg make una help me reason this matter o..
Una believe say the pikin wey dey 21 years fit rape e papa wey dey 50 years?
Why people dey always blame devil wen dey don catch them for their bad thing?

Na @nmalove carry this matter come.

DQmQkNYBpYh7mPEJV6KFqxCfneCsy8kYxgzH7Lg91z6zf7o.jpg
Na @mittymartz design this ogbonge avatar

Sort:  

Omo this one weak Me oh, wic kin kasala be this sev.

Some people when they born pikin way too fine, this kind tin dy happen.

How that old man son go dy talk say nayim Pikin rape am, na wa oh.

This one no normal at all. This one bad.

Na calamity and abomination of the highest order be this jare.

No be small calamity.. This world don spoil.

Interesting and beta mata Dey rock naijapidgin blog every day. Make una keep it up I Dey enjoy unna. This one week me even to inside my kidney

The man face no look like who dem fit rape sef, e. Face no de smile at all .
Na the man go find e pikin go , so my own be say na the man go find. E pikin goand no be e pikin rape am

Over and out! I be @catoranking

Me sef i tireooo, the face strong no be lie..

Good morning and happy Friday.

Based on the tori wey dey ground. Me I believe sey the man never ready to die. Him for jump from top of 5 storey building make we see Watin for happen. Lol

As for me, I believe say the man talk sey Na him daughter rape am just to justify him actions. But Na shameful thing for papa to dey do this kind thing with him Pikin...

Una well-done o @naijapidgin

Hahahahaha... Before the neighbors go come, e don die finish.. No mind am, na daughter and devil push am. lol.

E sure me say na lie the papa de lie o...dat girl no fit rape am, the best whe she fit fo na to seduce and that one sef get as e be...nothing whe we no go see for we country...naija i hail thee

I still dey wonder how person go lie that kind lie


This mata taya me oo..
Nothing way we no go see for this world.i no believe watin the man talk say, na him pikin rape am. Na lie.
If him say na the pikin rape am, how she take rape am? Why him no do something like struggle or fight? Why him no shout the time way the girl wan rape am?
The thing show say the man like the thing.
But then I dey think what about the mama inko?
Na all this kin thing dey make me say, mothers dey close to your pikin especially the female pikin. Make them your best friend way be say if anything dey happen, she go fit get mind tell you.Una good morning @naijapidgin..

Na watin I get to contribute be that

This your comment weak me.. The man suppose shout like woman ba.. Hahaha.. I no sure say the mama dey house with them.

Lol....
If the mama no dey, at least neighbors dey na

Naija o
Wetin person no go see and hear
Which kin matter be this one how pikin go rape papa she drug am abi she tie him hand and leg
Wonders dey o
Abeg make una no vex i confuse for the matter i no know wetin to yarn put

Abeg no confuseooo..

This one weak me oh , chai , see the mumu pikin sef

Abeg, this man need slap.

Where the girl dey when her paper dey talk all this thing?

D landlord no wan hear story oo,, nways dat man suppose enter okere o, only 1day inside dat place go correct e thinking

The thing fit dey possible na she is possessed😁😂

My brother.. This our world wey we dey so anything fit happen now adays ooo...On a normal day I for believe say nah the pikin rape the man. But as I see the man face.. This man nah very agile man oooo... E no fit be as him talk am. I pity am sha.
#konji nah bastard