My country people una good morning o. How una dey? We believe say we country dey do una better for body.
Today na another day and naijapidgin don carry another ogbonge Tori come una domot. You know who Aliko Dangote be? You go at which kind yeye question be that abi? That na because the name na household name.
credit
Na so news reach us say Aliko Dangote pikin wey Dem dey call Fatima marry her heart-throb wey Dem dey call Jamil. The party no be here o. No so plenty money dey fall left right and center. Na the cars abi na the hall ani na the cake abi na wetin I want talk self.
Aliko Dangote na the richest man for Africa and Jamil papa na the former Inspector General of Police for naija. As you don hear am now you don know say no be small pikin wey were agbada dey go that kind marriage.
credit
To make am sweet pass na so Dem package gifts inside smart travelling boxes nak people wey come grace the occasion.
This man wey she marry self own don better. Chai! See money oo
No be small money my brother
The matter simple na, Oyibo say birds of a feather flock together. You no go ever see Ole fowl dey follow pupuyeke waka
Abeg wetin be pupuyeke
Duck. Lol
Omo, y me i no go that wedding? This tori don swt me pass food o..
Me self wan marry rich person, i know say i no get money but miracle fit happen sha
😁😁😁😁 laugh want tear my belle
Lol
hahaha no worry e go happen, na faith you need @adabless
Amen, my faith gidigbam like iroko tree
I see am :)
Lol
Naijapidgin, make una no bring this kind news come my domot again, na watin? Gbedu don finish b4 una dey come tell me, how i wan come take get my package na? Wen una for tell person say gbedu dey ooo, make una go collect una own oo, somtin don finish una dey come tell me.... See as the tin dey pain me for this package wen pass me.....chei!
No vex next time we go let you know on time.
Nawa o see money,thats why the rich go always dey rich.
Why e dey happen like that?
Na only for nollywood rich man pikin dey marry poor man pikin o. And I feel say dem dey see themselves marry because of their circle of friends. Na rich man dey befriend rich man. Dem get where dem dey meet.
Dem really get where Dem dey meet my brother. God go help us.
Boss please voet have me yes, please
No mind them na so them they do, they go dey marry themselves, no worry zizy baby when i don blow i go come marry you asap
Hehehehe okay I go dey wait for you
Chia,abeg dangote get any other pickin
@switmag I go ask am for you.
hahahahaha you too funny
Lol, I love your concept bro. Nice one
Nawa oo
Me too go get money, one day.
Nawa! See money o. My prayer bi say papa God go bless their marriage o. Me i like better good news.
Abeg @naijapidgin u no any pf OBJ pikin or relative even if e no fine...i go marry am like dat...i wan marry rich man pikin too oh abeg i dey advert my self...no fine just make ur papa get money e don do me
@naijapidgin. Thank you Wella for this ogbonge Tori u carry come meet us, for here.
I no fit laugh for dis your statement 😀😀
Make we leave matter for where matter dey. If dem (the rich people wen dem dey marry themselves) want answer your question na... Na there you go dey hear, that's how we roll
Money make am for brain, poverty Nai be curse
Na this kind wedding I for like go before o. Correct mogbo, moya. Chai
I for carry one box, rush go outside go keep am then come back do face like person wey just come so them go give me another one.
Afa if we use naijapidgin as tag una go vote our post