SUFFERING AND SMILING

in #naijapidgin7 years ago (edited)

IMG-20180526-WA0003.jpg

We dey hail o!

My country pipu i hail una dis ogbonge weekend morning. I wan believe say una turn up for TGIF yesterday night and na so the jollification go dey continu as we dey groove inside the weekend.

The mata wey dey ground today sweet me for belle and i sure say your belle go sweet too.
Una sabi say we naija people be correct pipu, we strong and we sabi hustle wella, we no sabi dull na why we no understand am wen dem call us "lazy". But also we sabi say plenty plenty suffer dey inside this we country, some things no dey work and some tins just tire us!
But today i wan make we talk one better thing wey we dey enjoy for this we naija becos me i sure say some inside this our suffering e still get wetin dey make us smile!

Harmony inside hustle

Make i talk my own...If i go visit my mama for market, sometimes one of the women go born pikin na so all these women go dey happy and their celebration na to dey dance and carry white powder dey rub for their body and face!...this one dey show unity even inside deep poverty and e dey sweet my belle.
I go come finish my own with the free cinema movie wey i dey always enjoy inside naija bus...chai, this na why i still neva travel go abroad.
Even if i don tire, the kind comedy wey i dey get for inside bus dey alwayd bring me joy.
My pipu abeg make una come tell us the sweet things wey una dey enjoy as we dey hustle for we naija!

Na @preciousimo bring una this one for Naijapidgin.

IMG-20180526-WA0004.jpg
Na @mittymartz design this ogbonge avatar!

Sort:  

Wetin me i dey enjoy for this naija be the comedy wey dey happen for senate
Transmitting ehn trans transmitting

That word Suffering and smiling reminds me of the song by the great fela Anikulapo-kuti .

The savagery wey dey for we country na hin dey keep me going, If I log on to twitter for naija trends like this eh, na so so laugh I go just dey laugh till I even forget say my acc balance no fit save my life 😂
that twitter is filled with crazy people I swear 😂

You no see yourself, na because of free film inside bus na e make you never go obodo oyinbo.. My brother, your own is strong 😂😂

True be say, if we keep talking about our suffer suffer without talking about the little better wey we dey enjoy.... even the unborn children wey dey queue for heaven no go gree come naija again....

One thing me dey enjoy for naija na freedom ooooo. ...

I can call someone an idiot and the person no go carry me go court. Infact the person go follow me laff untop the curse.
I can flog people pikin and no dust go rise come tell me say na child abuse.
I can shout,clap and screem my voice out in my house, car and on the road and no adam go tell me say na noice pollution.

I no de enjoy anything ,i don tire for the naija sef