Today nah your day do shakara @ogoowinner

in #naijapidgin7 years ago (edited)

IMG-20180321-WA0004.jpg

My country people I hail unah o!
How unah?
How unah take d hold body for this change?.

We Don land again with another ogbonge Tori and today own we want make plenty noise yes noise.

No beg me because today all of us for naijapidgin no fit keep quite.
You know why?.
Because our one and only @ogoowinner don add another year to plenty of the years wey God don sama her with.

Hip! Hip!! Hip!!! Hurray!!!

Today all of us for naijapidgin community the join mouth the celebrate today with you, as you don add another year to your years, so nah so so blessings go the follow you.

For this new phase of life wey you don enter so, nah so so God go dey Grant you all your heart desires.

For all the contribution we you don add to steemit community and for all the love wey you don show us, nah so God go the shower you with blessings like water, like rain wey dey fall, in fact more sbd fall on you.
IMG-20180321-WA0003.jpg

If I start to d talk all the things wey our mama don do for us I swear we no go fit leave here today.

Abeg make we join mouth celebrate her for the comment section.

Nah all of us for naijapidgin admins bring this one for us

if you like to join us for our WhatsApp community wey we dey yarn

Tori every evening run enter here
IMG-20180312-WA0002.jpg
Nah @mittymartz gives us this fine avarta.

Sort:  

I greet you oo @naijapidgin i be your new follower, i dey observe your old posts and i see say you be baba for the pidgin matter. Carry on!!!

Happy birthday beautiful mama,more sbds to ur wallet.

I celebrate your majestic @ogoowinner.

Oya na, u don see am, who say Bros J no de, chaii pikn fine anyhow, oya make way. Happy birthday omoge, flexure and shine on. Sempe!

I no even know how go say Happy Birthday for pidgin.
But anyhow e b, I wan use this medium take congratulate the only maama wey I no for steemit community.
since I no her she don add plenty flavour for my life for steemit.
I say thankioooooooooooooo to @ogoowinner.
Happy Birthday to mama @ogoowinner
God go proper you, make you dey successful and add plenty years to you.
today Na your day make Sahara.

Happy birthday Mama. I no get words to talk all the good good things wey you dey do for my life na only baba God go bless you for me. As today na your day, make e be the beginning of better ogbonge sweet sweet things. Happy birthday

ah our aunty @ogoowinner, I follow celebrate you o, she name pesin wey Don influence my life positively since the day wey u reach here, do shakara join o, baba God bless u for me

Happy Birthday to you @ogoowinner.
Make you enjoy your day scatter. I pray say by this time next year, you go done growing pass like this in every part of your life

Flex well o

Happy birthday mama @ogoowinner. Blessings fall on you. Na ur day. Enjoy!

i take this time greet you oo @naijapidgin, your majesty happy birthday to you oo,u go live more years on earth more sbd to your wallet

Happy birthday to you @ogoorwinner wishing you long life, prosperity and the best in all your endeavors in life. More blessings to your elbow, grace upon grace over you. Once again happy birthday.

Happy birthday, dearie

Happy birthday ma GOD bless you have fun

@ogoowinner, you too much mama, GOD go bless you plenty, you go continue to dey win de go, as you enter another phase for your life, na so so win win you go de win, you go win so tey you go go win new motor, you go win the heart of that beta man wey GOD keep for you, you go win everything wey your heart want IJN

HAPPY BIRTHDAY MA