You are viewing a single comment's thread from:

RE: Snake wey go swallow millions. How una take see am?

This my country Nigeria matter eh tire me like say make I run commot go another place but I no go go anywhere we go tanda for here until d country matter change "we die for here".
This money and snake matter eh as I dey hear am e d dey me like film weiting d happen for film nah for naija e d happen for real like.
Dis APC people don too use us play ten ten and nah because then see say once Dem lie one lie naija people go collect am Dem no go do anything about am (like Charlie boy talk am "our mumu don do")
Make we youth stand up fight make all dis play play talk stop abeg e sure me say dis kind thing no fit happen for yanki.
Make I even asked this question how the Money take d office wey Dem no put am for bank.
How d snake take enter d office wey b say no body see am.
Abeg dis one nah big like wey APC want use chop our money run again like all the once wey Dem don de do
ABEG PEOPLE OUR MUMU DON DO!!!!!!
Make we youth open our eyes

Sort:  

Our government think say dem fit talk anything make we believe. Whether na snake abi na human being, the money don go. As election dey come make everybody shine eye wella o.