Oga Oloyede no go wan try rubbish na, if na him chop the money make him vomit am.
I dey sure say na for 2019 election, na why dem talk say na mystery snake swallow the money.
This APC just legalize corruption and we no fit do anything. Time don come, this yeye thing must stop. This na the time wey our youths suppose be on their toes. We no do mumu mumu again.
This party wey no get human feelings must commot, make better person come in.
Na wetin bad government dey cause. Time don reach wen our youth go shine their eyes well well, make we no dey fall our hand again.
but na which party come better na, all of dem na almost de same, before election dem dey be like messiah but after election na storry we dey hear
We need God my dear.... All of them be craze ppl jare
Yes o, God really needed