My own plenty o but mk I yarn my aunty own. The woman sick o like better sickness, e dey like say na dat one dem dey call diabetes plus small hypertension!! You see Wetn happen?? Nasoso church pastor's d use m chop money o!! Pay this she pay pay that she pay. E get one time like that wey she pay close to 600k for prayer/deliverance session laidat. I come ask am aunty Hwfa now say even when Jesus d heal pipo say e no collect money laidis y person go do u this kain tin?? Oya I con d do research tellam say u go d get food timetable i.e u no go d follow us chop anything wey u see plus exercise small. She gree o but after 3day e con d like say I pour water for fawl back. Anyway long Tori short, she don die now!! If na now maybe I for talk to me for better sha.