To me I go say na lack of knowledge wey our parents or guidance dey get dey follow cause am.
Dem no know say early marriage dey cause big wahala fir the girl health. Both physically, mentally, socially and emotionally.
Even sef the girl fit get wahala of the viganal in the process way she wants born.
Also love of money and poverty dey cause am.
Our parents or guidance no dey consider anything as long as money dey involve. Then own na make them get the money.
But if our parents or guidance go get knowledge about the thing. I think from their the rate go reduce. And also may government dey educate people and put law for ground to secure the health and life of our young girls.
Una gud morning.
my person u don yarn well
Smiles..
👍👍👍