You are viewing a single comment's thread from:

RE: SUNDAY MATTAZ WEEK #2

in #naijapidgin7 years ago

I no go miss this one oo my people,
As today dey hot i need to drop this one here too
IMG_20171231_103732.jpg,
Since today na our malee [mumsi] dem day, the thing way happen for church no be small somthing,
Todays nai all the mumsi dem for anglican church celebrate MOTHERS DAY world wide and u suppose know na say when mumsi dem dai do things like this every were go just shake come hot join like hot paper soup with fresh fish😁.
Nways church service today come get levels die cos no dulling moment even near the place, n e come be like say baba God just from heaven ehh come down to come witness the kind things way this mumsy dem display today oo, n i sure say baba God take emm tym wella becos ee just dai like say we visit heaven small😁.
Their theme na : the Godly woman
Text na from :1peter chaptr 3 from vrs 1-end.
Dey really teach many things oo and some include.
Talk show
How mumsi dem suppose teach dia pikin dem God tins
How mumsi dem fit start smal buisnes to help dia family too, especially for dix kind naija way head burn plenty popsi dem,
And so many othr things too oo.
Well even some pikin dem come decided to display join oo soottee dey come dance jolly for the mumsi dem too
IMG_20180311_183836.JPG. IMG_20180311_183814.JPG
As the place dai hot dey go our maalee dem (mumsi) come decide to display small tin tooo finaly come end am with ogbonge prayer and blessing from the eldest mama wai dai onboard
IMG_20180311_114416.jpg.
As them finish service, na so the mumsi dem say make every body come go locate and migrate to the side were item 7 dey, were rice n stew very plenty dey hapen. Omo una need see the food sha but i no go upload am here so that some people throat no go fall oo.😁.
Nways my people my people na so my sunday service take go sha but incase u never chop sunday rice till now beter enter warri come locate me as e stil dey hot here,. una weldon.