Una try for this interview. I just dey laugh since. The mimy noodles funy sha. Hunger na mad woman, i feel say hunger na man before.
I no get any question cos una finish work. When I see @Ehiboss and @Mimy, i go just dey wish say i fit jam kind love wey dey close like dis.
Aside say Mimy fine like miss nigeria, when i see her for Abuja meetup. For my mind, i say chai! Ehiboss na only carry this babe wey fine like 4 people. I wear my sun glasses take look her well cos i no want make Ehiboss catch my eye dey look him babe. d fear of flagging dey real.
Naijapidgin una well done. Mimy u too gbaski and tell ehiboss say i dey hail him government onto say u be him First lady.
Lol...