For which draw?

in #neoxian2 days ago

Na the same thing wey you talk when e. E points. You never learn?
Baba show me table to justify ur claim say I de pass u with eleven points.. Wetin ur chat Wan do for me
Chill na...I dey group. Your blood dey got for this draw
Una no go do anything.. Na same script una de repeat over and over again

untitled.gif

For which draw?
With Everton wey de always give us problem... Na normal result e be.. Like say u beat the Everton for ur barren stadiun
Una supposed don tire for false hope by now...
Lol...e no concern me who dey give you problem. Every team get Thier boogie team
That one move excuse
Na u de fine talk for where no talk na... I stil de wait for the eleven point gap Sha o
Person wey almost give Lines man red card
That one na craze man
Na him give Netflix fc hope wey them think say they go overtake me... Arsenal for that matter
There season highest goal scorrer is out for the rest of the season sha
Those ones de cursed na... So Facebook Naso there fans de pray for Salah injury, now na them de lose all ther strikers.. U de pray for persn downfall instead of focusing on ursef
They didn't learn from you 🥲
At all ooo
Now my players no de go lengthy injuries again
Yes because you have learned your lesson the hard way. Allow them do same
Those ones no de learn
Next season na another season of new drama for them... High hopes from the start and disappointment at the end
At least them de get hope
E don turn India season film
E no de end