Na bank be this,na one of my favorite place oo,na everybody kuku like money,I no dey lie. Na bariga, Lagos this bank dey
How una dey my people o,I hope say una dey well?
Na @ogoowinner organise this contest so, me don dey find way wey I go fit express myself for pidgin thay thay for this platform.
Steemit na blessing for my life ooo, make I tell una small Tory.
Me just wake up one day like that,come decide to dey post poem for my social media handle,na so the thing catch the attention of one of my Paddy. He talk say I fit dey make money with the poem wey I dey write. As I hear money,na im my ear open o,na so he Yan me about Steemit.
As I dey journey through Steemit,I think say make I just earn my money, mind my own business but Steemit no gree me.
Since the day wey I don join Steemit,my relationship with people don increase in quality oo,me wey no dey too mind other people before I come become friendly. Another thing be say Steemit don make me improve on reading and research work,as we all know say Steemit no dey collect anyhow thing.
Last last ,the money wey I dey receive from Steemit sweet my belle no be small. Me sef come dey independent.
My people ,na my Steemit story I just yan una so
I gave you some lovin How bout you give me some too?
Steemit don help person life for here. Including me. Steemit na great platform.
Your pidgin is lit
Thanks
Steemit is BAE
Yeah ooo
Steemit dope die oo, i swear.
See has it change u oo
Abi na
Babe, your story dey sweet me o😘😘
Thank you
You be bariga guy? Anyways your tori tanda.
No o, I dey waka pass there na so I snap am
Lol, make your belle no burst o, cos of plenty steemit money.
Lol,burst for where. My stomach gt estate