**Making the Steem social network better, we need the block button. NPC**

in #npc7 years ago

My pipol i salute una all. I say make I chuke mouth for this matter wey @ogoowinner throw for us in our ogbonge #NPC.

The matter be say the need to put block button for Steemit account

Here is my entry to the tori wey dey for discussion today
As I see this topic e sweet me wella coz na this kind thing I bin dey think of make them add for Steemit

As e be now, e get some energies wey we no need for our lives..
Some comments fit discourage people l, some comments as well fit give person bad name

So the first one I go like make them adjust put for Steemit na the delete button
E go make sense well.

The second thing wey I go like make dem add na
To see those who viewed your post
My people eh I bin sit down one dey come check one of my post, I com see many eyes wey viewed my post but the eyes no match the upvotes...
I come dey wonder if na spirits be that lol😂😂
So if them go add this one e go still makes sense too
Make we dey see people who view our post on Steemit..

Another one wey i want make dem add join na notification button

Atleast someone fit add someone close like for facebook,
U fit add someone close, pesin wey u dey like the kind thing eim dey post so you go dey get notification anytime dey post here on steemit..

And aswell make I dey see people who mention my name
And make people I mention their names fit see say I mention dem too.

image

The picture I used na Chimamanda Ngozi Adichie she be Nigerian writer of novels, short stories, and nonfiction. As I don learn many things from her personally 💯🙌

Sort:  

I'm from morocco, we are in Africa and proud i'm following you


I'm from NigeriaThanks @askmee

Bros which side you dey for Naija.

Enugu
What about you??

I'm also in Enugu around achara layout.