Pidgin challenge-wetin make me like steemit.

in #npc7 years ago

Before i find out say steemit na one sure map,i been broke like this ehh. If you see me that time, you go pity me dash me money. But as i come sabi say steemit the pay, i join, ever since wey i join, my life don arrange like this. Now i fit eat better ofe owerri and fufu. As steemit come show me love, my mumsy birthday wey she never celebrate before, i been run her birthday well well,no hold up . Make i show una my mumsy birthday picturesIMG_20171209_142301.jpg
![IMG_20171209_142323.jpg]
()
IMG_20171209_142044.jpg. Why i like steemit be say e the pay and e go make person fresh. Steemit help my life like this ehh. During that new year day, because say steemit sabi show massive love, i been use am kill goat for my family, everybody get joy that day, make i show una the pictures ![IMG_20180101_092819.jpg]
()
IMG_20180101_092945.jpg
The new year been make sense over for our side.
I wan use this opportunity thank @ogoowinner for this opportunity wey she create make we take yarn this yarn. Babe you be correct, wish say i fit see you right now, i for cut goat meat give you.
Babe wey sabi body, babe wey the ginger for steemit. Steemit don help me meet correct people, sure sure people like this. Steemit na the only way for guys to use build that our dream house.
My life over arrange because of steemit.
Steemit i hail you like this.
My two hands the for up

Sort:  

bros i dey hail you ooo

Baba na me hail you pass

Oga na Steemit sure pass o.

Your way pure bro. Na so you kee goat you no call boiz make we for lap your bunk. Na like this we go dey?
.
Make I no forget. Your mumcy correct o. She go don happi scarra as your arrange her bday. You for kukuma tidy steemit logo for her cake na. How you see am?

Chop your bar bro. Me still de come up.

Baba i go call you next time o

Bro... I feel ur post waaah....
@dreamwhale
@euronation

Thanks correct guy

Your entry rocks bro!

Wow! I hail your mama o.

@ogoowinner nwa di very sharp..
Kee kwanu your side ?