My pipol,I don land again.Madam @ogoowinner don carry another ogbenge pidgin challenge come again,na God wey dey up go dey bless you @ogoowinner for this chance wey you dey give us.
Me believe say every pesin get right to be seen,heard and loved
Me believe say all man dey equal
Me believe say the world dey big well well to fit every pesin
Me believe every pesin na genius for one side of em life
Me believe say every pesin dey special and unique
Me believe every pesin get beast and angel inside am.So me go try my best make I control the beast and make the angel comot.
Me believe say all race, religion and social status be nothing but the creation of contentious men wey dey come dey control others, come dey cause strife and in-plant the supremacy mentality. So me don choose say i go be "human first" before i go be of any race, religion or class.
Me go try hard to dey understand pipol well well, so i no go dey misjudge pipol.
Me no go allow envy, jealousy and greed control me.
Me go everly try my possible best to do something for humanity, wey all man no go ever forget even if i no dey this world again.
Me no go ever allow make fear intimidate me for this life.
Me no go ever free myself for were negative thoughts dey, i go always over power am with righteous thoughts wey go impact for pipol life.
Me go always be my self,i no go copy any pesin.
Me go always try to dey think positive for any given task wey i get, so i go come out with positive results.
Me believe say life na journey no be race, so i no go allow myself to come dey compete with pipol.
As i dey now;
Me beleive say all man get right to be loved, seen and heard.
Me come believe in peace.
Me come believe in charity.
Me come believe in forgiveness.
Me come believe in love.
Me believe in mercy.
I believe in human race.
Me don make decision say "live" no be merely "exist".
I, Obiagha Clinton will abide by this creed all the days of my life.
Make i use this chance thank our fine madam @ogoowinner wey carry this ogbenge challenge give us,madam me go dey wait for another challenge oo.