My counry pipu,i dey hail u na o, our auntie @ogoowinner don come back with another ogbonge contest,wey she call am Naija pidgin contest.
As u dey read my post go, i wan yarn u about block and delete button, before i start to yarn you my tori ,make i first thank @ogoowinner,@gbenga,@ehiboss with all of una good pipu wey dey make steemit better for us,tiri gbosa for una!!!! I be new baby for steemit going through our mother @ogoowinner post na him i saw this contest. I come say I must not carry last for this pidgin contest.
make i first jump enter the block botton matter,una no sey d place wey sweet thing dey happen, wey bad pipu wey dem send cum from village go one put head spoil am. Me wey write post for five hours wey I don crack my metabolite brain,i cun post am finish,na him some mad people will come dey comment Yamama for the post,or make e dey tell me say my post no dey ginger am,why e go ginger you? e resemble igbo ni....and many wahalas dem wey dem dey cause....if tosey d block button dey so...me no go think am twice,i go block all e generation dem,dem go no say man dey hot. They think say he easy to write post.
@ogoowinner if dem fit do this one for me I go blow Dem kiss wey big pass Nigeria.
d second matter about the delete button,this one too fo help pipu like me sef because sometimes ehn,wen i don write a post,if i don post am finish and me no gbadun am well like d good ones wey sabi atract my pipu dem,e go dey do me sey make i delete am but the botton bo dey for am,if tosey d button dey so,i go just delete am kiakia before dem shook eye for the matter.......i dey sure sey all of we na wey dey steemit go gbadun d block and delete button wella.
I won give big thanks once again to our big mama @ogoowinner for giving us this opportunity
I won make una help me upvote I'm still a newborn for steemit weh just dey learn
Thanks.
You fine oo my sister. Fresh like fresh
Thank you my sister I'm looking forward to learn from youl
wish you well
You are beautiful dear
Your pidgin make sense die abeg
This your Tory sweet die. Abeg no block their entire generations o. Lol.
I also wan welcome you come steemit. As you don't land here so I pray say Na so so better better you go dey see. Me sef still be newbie. Make we dey rock am dey go!
i swear my body coolee wen i jam ur post for here.the tori sweet me sotay e wan burst my brain.you try wellu wellu,abeg keep am up and as you take dey do am we go dey upvote for the matter.