My NPC entry: Wetin Friendly Enemy don do me

in #npc7 years ago

E don happen again o, this one na the kind thing wei we fid refer to as;

green snake for green grass

IMG_20180122_175603.jpg

Why i tok so be say,this kind pesin go blend wella with u sote u fid no suspect am sef.

So my own tori na this. E get one very fine girl like that i bin take as my friend,infact we just align for most mata,unto school stuffs.

But i come realise say,as me don jeje take am wholeheartedly as my friend wei i fid call sista sef,the truth be say she no take me like that.

E get one thing we bin wan do togeda,i bin tell am sai me no ger money to do am now,but as u go meet the pesin we go fid help us do am abeg tell am sai na u and your paddy o.

So when i come get the money wan do the transfer, i come realise say,she bin no even carry me along. The thing bin pain me ehnn.

So na so i bin sidon,think sai i get pesin wei i fid trust,and i no know say na lie.

The ting wei pain me be say,when i come ask am,she no even show remorse sef,she com prove gimme like say na me be dey fault.

E bin pain me ehn,sote i fear say this kind pesin fid go behind me do bad ting wei fid change my destiny,make I kukuma leave am now e neva reach had I known tori.

So my fellow steemians,make una dey careful,the kind pesin una trust,cause e fid be lie.

Una wehdone o!!!@willizgallery

Sort:  

No be lie my sister...e no easy to find pesin wer yu go fit dey call sister again o...
But you na my sister sha... Our own na sure something..

as in eh,our own go turn blood from water lol, no be blood is thicker than water

Hahahaha... Na the way oo