@surpassinggoogle ask Who i be?? : No tallent, as everybody na winner.

in #pidgin-english7 years ago (edited)

PicsArt_10-12-11.47.15.png
My people! I no sabi wia i go start from as i still be new comer for hia, and i still dey learn am small small.
My steemit name na @ionlyspeakpidgin, my real life name come be Mr Jim Uche.
I been don talk about my self for hia before, see wia i for talk am here

As i dey flex my self for steemit inside our nigeria tag, I come jam one post like dat wey @dayjee post wey he call UNTALENTED: Who is dayjee? As i read the guy post finish, i like am come drop coment for am. before i go know i done get many reply from men dem, even @surpassinggoogle self reply me, say him self go like make me self join he noTallent contest.
Screenshot_2017-10-13-00-22-12.png

I happy wella, because me be no kno say plenty opotunity like dis dey hia. So make i drop my own now.

Who i be? @surpassinggoogle dey ask

Where i from?
My people, i from Africa.
The Africa wey born Nigeria wey be the giant of dem Africa, the giant of Africa dem come born me.
So i dey proud wella to come from nigeria. We no dey carry last for any thing wey we wne do, we dey comot from nigeria hia enter oyibo man land go still follow dem drag first.
If u be naija, upvote dis post one hand.

Where i school reach?
My brother! If i tell you say e no easy for me no doubt me ooo, As na me be d first son inside 6pikin dem. Am my papa dem no carry plenty bar, na 0 level i stop.
Hope still neva end ooo, if i begin get better pay, i go chook head for national open university.

Wetin i dey work?
My brother! for get Giant of Africa matter ooo, Thinx still hard here oooo, but no le-le hungry no dey near me.
I neva get daily work or office work, But Hustling na our motor, anywia he carry us enter we go chook head.
Na the same motor carry me come steemit.

Wetin i like?
Hahahhaha! i like play wel-wel. Anything play. i carry am A1, from small pikin. kpakpangolo, super-mario, mama and papa play, ball, funny gist dem, playstation game, boris, if i begin metion all of dem we no go reach wia we dey go.
Jus call me play-play.

Wetin i no like?
I no like fight atall.
I no like to dey form, or wetin dem dey call acting bigman.
Jus simple and tall

Why i carry pigdin enter steemit?
I don waka inside steemit, i come notice say no be wetin dem do copy-copy, or form wetin u no be.
As i no sabi blow big-big grammer, e better make i dey do wetin i sabi.
One dey oyibo peson fit learn atlist one pidgin word from me. Na him be say person done still learn from me.

E be Like say we go stop small here

Thank you as u comot ur time take read dis my post

Make i use dis opportunity holla dem boss wey dey support me, comot cap for @ogoowinner @ogochukwu @churchboy @infovore.
IMG-20171012-WA0016.jpg

Upote am if u like d post

Resteem am make ur padi dem fit see am

Follow me if you like me

Steemam as e dey hot

Sort:  

Area!!! I hail you Baba. What's d level Na? How yonda for upland. I troweeh Salut for this ogbonge niche Wey u don drop for #Steemit.. Even @surpassinggoogle don confirm ur matter. Anyhow sha, e good as u don yarn us who you be. I go corner you for one side later. .
Na Minnow Wey wan turn whale
@michaelcj

Area, u dey every corna.
U don get levels wella for here, come still gather many men dem join steemit.
I dey hear your scores.
Make i run follow u

Abeg Bros your talent dey too much, carry dey go, e no easy make man pikin to dey speak Pidgin English wey everybodi dey blow grammar. No be small thing, I dey trowey salute.

Na the koko?

Na the koko be that, to dey speak only pidgin no be beans :)
Ask any pesin wey wan try am. Lol

Bros, see as you come dey make me get levels for yonder. Shooo. As you dey mention me join all these big oga dem, I come dey feel like say I follow. I hail you pass.

See the koko

Bros, na the koko be that. BTW I just love your posts. The last one just inspired me to write something nice and to change my approach to certain things. Thank you for showing us the original, no be photocopy!

@churchboy you dne show me plenty love here, u follow for my boss dem

Why I no go love you my brother? I sabi book nah :)

Greetings Oohh. Na Wetin Wetin we dey find be this. Followed and Resteemed

how una dey @ionlyspeakpidgin

omo see how ur pidgin fluent pa, u even confirm am say naija no dey carry last anywhere we be, na confirm word be dat

sha dey steem on and dey ginger us, no be only salute i give u, i give u more sef.

na ur boi o @valchiz

I swear una dey give me joy, as i dey read una coment.

@ionlyspeakpidgin,
Oga boss, i gbadun dis your article, i just dey smile as i dey read am,
im be like say na from warri you come from?
Carry go boss.

I gbadun you pass, as you join read my post. I dey happy hia.

you are right! friend,

Another nice post.. thanks

I dey hail ooo...! U do well to use pidgin-english dey write. As dem born me for Delta State for Naija, ne pidgin-english we dey take run things there. So, bros. I like pidgin. Na so so laf, I just dey laf wen I read your post. Abeg, u fit dey do podcast for pidgin make we for know wetin dey happen for ur area? U fit use dsound. Dem go roger u 25% sha. How u see am?

Lol. Hahaha. This roger no b small o. This pidgin dey sweet.

How far na bros, @turpsy? I hail ooo...U sef don show for here? No be lie, the roger no be small. Naim make sometimes, if I think am, I go just tell myself say e better make I first upload my work for soundclound/youtube . After I go come put am for steemit. Na so. Well done, bros!

@maryfavour.

i don hear anoda one! dsound.? i go check am see thank you

No kain, bros, @ionlyspeakpidgin. Carry go!

@maryfavour una love too much hia ooo.

oh boy! dis is cool ma man! Neva heard dis before.
Is it Creole? How You Dey? . I no sabi.

Remind me of Bahamian english!

It is Pidgin English, Nigerian version. As the name implies @ionlyspeakpidgin :)

thank u, very interesting!

wait ooo @sunnylife i no come undastand u ooo. so u sef sabi speak pidgin?

I no sabi man. wat u talkin bout.LOL
I no no. I want to learn:):)

@sunnylife u mean am? follow me na make we dey yan. i gbadun you

I like u. Ur real! ur ma man!!
@amec is going to teach me some:)

Hm,, you be beta person, e good as you follow for this contest so,, abeg mae you teach steemians pidgin wella o,,, you dy try,, Tuale baba✌👍

@tony-duke i thank una ooo. I sabi say steemit sweat like dis.

Amazing great write up, @surpassinggoogle thanks for giving us a great opportunity to express our self, thank you.

Baba I dey feel your swag jare, carry go
Nothing do you.

@ememovic thank you oo as e no dey easy to peson swag. dat one show say una take me as una own peson.

Lol. My countri pipol, this our own here oo. This niggar get better talent no be small.

Oga well done sah.

@gunneresq. you dey make me laff, i neva see my talent oooo.

Lol. Oya make we join hands find am.

Make i no carry lie enter this matter, guy u don try pas pesin who born this platform self, being urslef no b gbege ooo infact i don carry my kaya join body follow you.

Abeg neva kill me befor my die com, i neva even try reach ant. Make @ned abi @dan no hear am for ur mouth oooo. No play reach dat area abeg

Bros, dis ur post make sense die. I comot cap for u. Guy, Naija dey proud of u jare

@samminator abeg wia ur cap back, he fit you wella.

No wahala. Guy u too much. I don join body follow ur ministry

The @OriginalWorks bot has determined this post by @ionlyspeakpidgin to be original material and upvoted it!

ezgif.com-resize.gif

To call @OriginalWorks, simply reply to any post with @originalworks or !originalworks in your message!

To enter this post into the daily RESTEEM contest, upvote this comment! The user with the most upvotes on their @OriginalWorks comment will win!

For more information, Click Here!
Special thanks to @reggaemuffin for being a supporter! Vote him as a witness to help make Steemit a better place!

my broda @sunnylife thank you. you confarm say na originalwork

am yah sista na broda! hahaa am havin fun man.

Omo bros I hail ooo!! I never see person like you for hia before oo, as I dey sama dis your post na sooo bele just dey sweeeet me. Chai you full griund remain. No be lie... oyibo go soon call you as PA ooo...lol. I just wan tell you say over orijo dey worry you bros and i dey feel your yarns. Make you keep am up oo. One day e go pay you wella ooo. Make I go market come back... meanwhile stay tuned my brother.

thanks you dey house market? Buy steem come back oh

@gloglo wetin man go do, as he be sey steemam na wia orijo tinx dey park. he go betta make i park well na. Abeg buy me Okpa, i carry Cold coke dey wait you.

Brossieeh @ionlyspeakpidgin

Lol, make me sef yarn some pidgin b4 I comot for here.

I bin dey see you everywhere for steemit comment. The first time wen I see your username, I troway salute.

This post come sweet me well well for belle!

Me dey feel you! Carry go bros!

My naija pikin

@ionlyspeakpidjin

I hapi wella as una take me as una own peson.

Lol guy u funny die, my voting powers no reach anything oh, so try manage the one I get

@samstickkz no talk sey no be somtin oo. money no be everytin. ur vote count join. I thank you wella

Congratulations @ionlyspeakpidgin! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of upvotes received

Click on any badge to view your own Board of Honor on SteemitBoard.
For more information about SteemitBoard, click here

If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

By upvoting this notification, you can help all Steemit users. Learn how here!

This one sweet me die... But bros no think National open university. You go just regret am.. I hail you sha, well-done bros.

@sweetestglo-eu na wetin i no kno be dat, abeg com gist me wetin go mke me regret am. abeg i need ur advice b4 e go dey late

I been go the school, them dey flexible for everything but before you graduate eh, you go grow white bearbear... plenty people wey i know never graduate... you fit ask people.

Paddy man, wida? All d way from ph city we deY hear d way ur hands they clap for steemit. I duff my cap 4 u.. Better days my brother.. All this one Oyigbo they do here na panpangolo.. Soon, Na naija go dominate steemit. We know they carry last.

Abeg wear ur cap wella, na boss una be. u sure say na kpakpangolo oyibo dem dey do?

Hello @ionlyspeakpidgin

Anytime wae I see your post. E dey sweet me for belle. You come dae make me write adn speak pidgin English. I believe say you go make am here for Steemit.

@ogochukwu