Naija I hail o!
To others, this no be una regular type post at all. If you sabi wetin I dey yarn, you fit read on or else, well, the whole story go just dey like Greek for your eye.
Naija and Language
So every small thing wey we talk about language, people go dey hala say Naija no get one language, Naija this, Naija that. But if you think am well, how you dey take follow that bike man talk? Ehn, that one wey no follow come from where you been come.
If you enter market for Lagos, how Igbo dey take follow Yoruba talk? How Yoruba dey take follow Hausa talk? You suppose don get answer to these my plenty questions now o.
The Truth
We don get national language since but we just no wan gree. E be like say na the same habit wey no gree allow us buy Naija things no want make we accept say Pidgin fit be our national lingua.
E fit be say many people think say na only people wey no go school dey blow Pidgin. One small journey inside any school for Naija go show say that one na big lie. E fit be say na people wey no go school start to dey speak Pidgin but as our people dey talk, no be who call police dey win case.
E mean say person wey start am no matter, things wey happen for past no follow for where present tense dey. We suppose look how many people dey speak Pidgin now plus the kind people wey dey speak am before we start to dey conclude say na dem illiterate dey speak Pidgin.
Wetin We Wan Do?
E don tey wey I been wan turn Pidgin to legitimate Naija language. I been get idea wey go allow people contribute words, phrases, them meanings and dem spellings (una see wetin I do for there?). Because as things dey now, Pidgin na more of oral than written language. If we really want make the language grow and mature, we gaz get official spellings, plus we suppose get our own dictionary sef!
Na since 2009 or so wey I don get this idea and as I no take do anything on top am, the idea go hibernate but as I just dey my bed today, the thing come back.
Shey Steemit Fit Help Pidgin Mature?
E be like say the possibility dey wey we go fit use Steemit organize the whole thing. I never really think am well so no concrete plans dey but I feel say I need take the first step, which na to put the gist out for una.
Language no fit mature if e no get e own dictionary. Structure and pronunciation fit join later but the first step na to gather words, phrases, and spellings.
So I wan hear una ideas. How una think say we fit use Steemit grow Pidgin to the level wey we go fit dey yarn say jungle don mature?
If you got to this and you're still wondering what the f you just tried to read up there, I mean, it looks like English but as soon as I start reading, it gets all messed up. Well, you just had an encounter with Pidgin.
First, Oga @fisteganos I tuale for you for dis your pidgin Idea o.. Steemit fit truly blow pidgin.. Na we go dey post with pidgin wey steemit go help us blow am.
Exactly. Na my point be that. Nobody go help us do our work. Na we go help ourselves grow. The more, the better!
good one man, really good one. if we pursue the pidgin thing as Naija wey we be, e go mature sharp sharp. we fit make am a channel but first we need to get awa pipo over hia
meep
Wetin this meep guy dey find here? Shey meep don turn pigin again.. See wahala for dem bodi o
meep
Lol.
meep
Make we wey don dey start to dey use the language well. E go dey easy for dem new ones to join.
bro fisteganos check out my post and help promote it if you can https://steemit.com/growth-ideas/@ejemai/steemit-port-harcourt-meetup-taking-steemit-to-20million-nigerians-the-challenges-and-solutions
na so..... dis pidgin sweety my belle yafun yafun.... ma broda abeg just dey fire go anyhow. Pidgin na we own and we go carry am with full 5 star general convoy take sama steemit, because pidgin na comfirm
of course pidgin dey very nice for bants and media like film & music dem, but e get plenty high level tinz wey dey hard to express for pidgin. but I believe sey we suppose get enough websites wey na only pidgin dem dey write just like how wazobia fm be.
True talk, but na condition make crayfish bend. When we reach that bridge, we go cross am but if we no even try, we no fit sabi if we go fit or not.
Wazobia fm na proof say Pidgin na more of oral language than written for now and na wetin we suppose change.
Na so boss!