Good morning my country pipo how una dey this beautiful morning i believe say body dey well we for naijapidgin dey salute una.
Today na Wednesday the middle of the week and we don bring anoda tori come for una as usual and na about the things wey dey happen for our obodo naija,the mata wey dey ground na the herdsmen and Fulani gbege wey dey shele since,one group wey their name be SHAC(save humanity advocacy centre) talk say na politicians dey cause the fight and dem don promise to expose the pipo wey dey behind am.
The SHAC dey lament say the killings and lost of innocent lives don too much for we country, Adams odoh wey be the executive director of SHAC talk say those political individuals dey take advantage of our weak religion system of the country take dey sow seed of hate among Nigerians because of their selfish political goal.e say e don ask ICC(international criminal court) why dem Neva dey prosecute the pipo wey dey cause the casala e don tell them to start investigation quickly to catch the sponsors of those criminals wey dey kill innocent pipo,despite the last meeting wey dem hold to reconcile the herdsmen and farmers e no work na the way to go now be this investigation.
Make we hear wetin una think abeg una believe say na politicians dey cause the casala.
If you like what the community is doing and would like to support us,
Please follow our trail via
Or delegate SP to @naijapidgin.
We are naijapidgin community with a mission to 'Promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows
Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.
On @naijapidgin discord channel, a lot of variety shows and lectures are ON
- Every Tuesdays we have real life issues with @preciousimo
- Every Wednesdays are unavoidable lectures
- Every Thursday we have relationship talk with @sparkles
- Fridays is our well known ameebo center by @rebeccafl
- Sundays is always variety night show by @itoroarchibong and @imbigdee.
- Same Sunday we have our @naijapidgin hotseat ( featuring some well known steemians)
You ought no to miss any of our programs.
TEAM:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner
@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde
Avatar designed by @mittymartz
Its rather unfortunate the type of unwanted killing in this our naija. Government tell us say dey go catch the sponsors of Boko haram,till today wey we dey talk so no single fly wey our government don arrest as sponsor of Boko haram. On this current issue of hermen and farmers fighting, I pray say make the investigation produce positive result..oh.
My brother thats to tell say. Dem sabi eachother
Amen o my broda.
The thing tire person o, Abeg wetin them still de wait for? Make them expose them make we know howfa na
E no easy like that na slow and steady.
Believe you me my brother, no b say the mattar no fit work oo. My own b say aw we go fit flush dem (selfish politicians) commot the system b my own concern. Cus dis pipo sabi demselves.
Them sabi themselves o no be lie na God go help us.
I bin tink say presido bin talk say diz herdsmen pipe no be Naija pipo, why immigration, DSS, army, SARS no fit catch dem? Dem jus carry us dey do tortory. I notice say na na only innocent pipo dem dey kill. You no go eva hear say dem kill any of diz politicians dem relations. Na God go deliver us o.