ABUJA
Based on based ehn, dis na d capital of Naija as all of ona know. The softness wey dey ooze for this coast na highest for the full country. The softness don real attract crowd from different holes come assemble for this arena.. The crowd nor get choice but to settle for pidgin make adagba nor for hang bulb-wire in the long-run.ANAMBRA
Still on still ehn, this state still get small levo unto the pidgin spirit based on say na jur river share am from the capital of Delta state.. dat na wetin white men dey call "clash of culture"..KOGI
O Bob! This state nor suppose sight road enter this list sha.. but still on the clash of culture things, most strong men here dey ball in Edo state steady unto one or two tiings based on say places like Auchi, Okpella etc nor too give Kogi state yard..CROSS RIVER
Calabar people sha.. Their pidgin dey sound like Chinese dat year sha, but some kind Urhobo boys don hustle enter there come give their girls belleh finish.. this belleh-giving nai make new generation calabar children dey tear pidgin like Sapele agbero these days.. Pikin must resemble papa unto one or two tinz na.LAGOS
Ma first hail some kind lost souls for this yard before I fire down.. Men like RMD, Basorge-Tariah, Ali Baba and other staunch wey abandon us go that way.. I jur like let ona know say nor be so o.. Cow wey smart go America go come back as cornbeef one day sha..
Still on still ehn, this state kari-get population from different parts of the country.. But we all know say dia pidgin melting pot dey Ajegunle where Area borku yakata.. Still on the hustle, AJ boys turn musicians o.. all we slangs for Area na dem pack full dia music.....and ona know say music dey kari-spread.. slangs spread so tey market women dey chew dem like gum based on say nor be everybody fit speak Yoruba na.. so d pidgin jur serve as dia lingua franca for dah way.... example of dose slangs wey dem thief na "Who You Help" wey Olamide thief from Shuun Bebe...AKWA-IBOM
No doubt, militants don teach these people pidgin finish based on the oyel tinz.. dem try!
Down to the big fourRIVERS
This na one gallant South-South state wey jur gather people from different tribes like Tower of Babel.. Oil industries borku for this state and even omormor know say business must full anywhere oil industries gallant put. These people of different tribes based on say dem nor get unified language come dive pidgin make quarrel for nor too dey sup unto business tidings.BAYELSA
Ijaw full this state nor be small.. Naturally their lingua franca suppose be Ijaw, but based on say d state near Delta anyhow, dem jur gat copy dia elder brother (Delta) main language make e for nor loss..EDO
Oba a to pe'e.. Before 1991, this state dey conjoined with Delta state.. dem regard dem as one den (Bendel).. This state nor be number one for this list based on say some kind villages there near Yoruba states like Ondo and Ekiti.... This kari-near don weaken dia pigin anyhow.. na jur Benin come get level unto the lingua..DELTA
Area!! 12 Kpokos for all the Nairaland Waffarians.. Any Effurun pesin here? Abeg signify make men observe ur kpai number..
Dem nor dey drag seat with Oba o..... The full state gallant for d pidgin level sha.. from Warri/Effurun to Sapele, Ughelli, Abraka, Oghara, Osubi, Asaba, Agbarho etc.. Area! ona too much abeg.. I throw backy give all of ona. Dem say overfamiliarity nai nor dey make man chop house rat..
Fly go gather any kporkpise wey like smart for this thread..
@naijapidgin @surpassinggoogle @stach
http://www.nairaland.com/3669698/10-states-nigeria-where-pidgin-english/
Akwa Ibom nor follow at all for this matter. Na only Ibibio and good English dem dey yarn here. Dey nor sabi catapult pidgin at all. Even the small ones wey open eye for the matter sef nor sabi am wella. Their pidgin dey sound like good English mixed with Ibibio.
As for Anambra, na Igbo dey reign for there. Pidgin nor too follow. Na only for Onitsha dem dey speak small pidgin based on Asaba influence and based on say strangers boku for there. So Onitsha nor too follow up. Even Asaba sef, na Waffarians dey spoil that town. Normally, na Igbo dem dey yarn but Waffi boys don change am follow them. Some Asaba people don even get Warri tongue now sef.
For Bayelsa matter ehn, Yenagoa na correct pidgin area. The people wey get the town na Epie/Atissa dem dey speak normally but Izon people and Ogbia people plenty for the cabal so na pidgin naim dem take dey control their matters for there.
As for Cross River, na Ogoja/Ikom/Obudu people get am. Their langua for there na konk one. Nor play o. If original Ikom man yarn pidgin for you, your head go roll like ludo seed.
Highest pidgin sha na Warri. Area!
Correct yarns Correct guy Na so.
No be lie u talk my brother
me wey dem born for benin my natural tongue na pidgin
I good for good and correct english because say i get talent for both latin course and english language
If no be this reason my brother english for don kpai tay tay i for nor sabi english like that o,i for dey break bottles on top english head like agbero wey dey collect ticket before oshiomole kon become governor.