Una good day ooo. I greet both my oga's and pikins in the house. How una de my fellow filfo. Hope say this cash wahala nova make ona run mad finish cos this life, wahala no de finish.
Haha omo see rhyme ooo... I don turn songwriter finish. Ona wan near ram. For where. Who de who de... Who de zuzu.
For the topic wey awa otutupoyoyo bring come like this, e first weak me as i sidown de look. Ololo come here first, how you wan make I see sepe buy if I save shingbai? But as e be sha make we de look.
I believe se as sudent, to de keep moni from allowance na wetin Solomon go do. Oya clap yourself if you de do am. You don get sense finish. No lele. You sabi.
We sabi wetin to de keep money de do bah? E better make person get moni for emergency reasons na abi how una see am. No use hello Paale and Maale kee your parent. No be only you de born.
Make we talk se dem de give you #100 for allawee de try get sense save #30 as per se that saving fit epp your life especially when those yeye lectures dem bring assignment wey go rekilll their ancestors dem. As human beans wey you be try de use your sense especially this time wey insecurity full ground like bazooka.
Me I no collect allawee wen I de skool. I be certified hustler and I de save for the little wey I de earn. Me also like to be save money because e don epp me achieve somethings wey I get. Try de save with purpose so e go boost your morale sef.
I no be your ancestors Solomon. Sense no fit too de wetin you read but as you see am so... Ntooorr. I don talk am. Make ona make way i hear se tuelele sepe don land for arena. Before I comot. Who get loud?
Dis na correct yarnings. Nothing pass make guy man dey save money for emergency. Nah wetin life for be that. So that when our may dey spend money we no do dey talk excuse.
Naso.. if we wan enjoy this life... na to save at the right rime.
Gbam!!! You don carri sense finish.
Yes oooo. Any pesin wet no dey save, nah him go dey beg from pipul wet save. Nah sense person go take follow.
E nor good make pesin dey chop with all him fingers.
You get ✌ so person go reap bountifully
Na true my guy. You carry Solomon brain. Go collect 1 zobo.
Ahaha. Only one zobo? You for add 2 puff-puff make e for take balance.
No mind me jare. Loud don finish me. You go fit add sepe and babadu make I use am hold body.
😓😅😓😅
I fear you ooo. You dey enter loud? Jeez, naija babes no dey hear word.
Word of the wise no de wise again. Make una no vex.
Ahahahah. Vex kwa.
Nothing like that joor
Abi make person dey look like stick.
Savings is actually good.
Chai,,, you don stay for thug area, walai....😂😂 you be typical naija babe wey dey blow pidgin still dey find loud to boost brain.. Nawa oo.. who be this pikin.. na who born you? 😂😂
Nawa oo... you no collect alawee when you dey school and you still dey save inside hustle.... I give am to you.. you be correct babe.... saving better ooo.. make everybody use their head because emergency fit show anytime and many times we no go see people borrow us money and we go come dey tight area....no allow poverty kill you before you no say to dey save na better option. I kukuma enjoy your story babe... yarn more abeg... 😂
Omo na only God know how de born me ooo. Cos my male sef taya.
Nasso we see am oo.. Make person hustle with brain before e go turn workmonger.
Anyhow e de make we de rock am de go like waist. Who get ear make hear.
na who get hear make e hear truly
Naso my otututupoyoyo.
Na better pikin she be she no fit slack check am well
If you no be hustler wey Sabi save for niger your name na sorry because e get time wey everywhere dey red you go need to deep hand inside pocket but if nothing dey there wahala don come be that.
Na e de make people de do Yahoo, ritual. Wey mouth dry ehnn you go fit do anything if you no get conscience oo.
Na so naa las las e go say God abeg na my enemy cause am
Enemies sef don suffer even when dem no de involve dem go still call their name.
No mind them
Na frustration dey lead some people into it.
Swears
And that kind wahala na something wey person suppose avoid because e get sometime wey the urgency go dey base on investment.
You don talk ooo. Congratulations you don successfully burst or brain for this matter wen sup like. Your comment con dey gemme joy. Abeg where you from bos out sef?
Hahaha 😂😂 o
You too saw what I saw? 😄😄😂
I don't know what we saw, but it seems I saw it ooo
Wetin you saw? Make ona try dey explain oooo before I wack you agbado and boli wey go generate electricity.
Omo. Abeg do small small.... E von dey do me as if say na loud dey Waka for yah
Haha. Aba calm down my nigga. Loud no be oshofree again. Cash no de una kwantry
Ona don start abi... No comot me for set ooo. I no go gree
Omo na inside maale belle ooo. I puff comoy for her mouth. Na true I yarn oo no be say I de talk like because say I take loud. Na true true.
You see that joy suntin na the ogbonge ingredient wey no de market. Anywhere you see am, my guy grab e buttocks
Murderer.....😂
Shhh... No too loud am.
See this full blooded naija woman from head to toe😄😄😂😂
How you take dey write this pidgin like this 🤔
Well, I understand today's pidgin
I don get sense now oo 😂
No matter the bill, I dey save tiny cent incase of emergency...me too didn't not see pocket money then oo 😂
Omo see better pikin fine chinchinee pepperoni. Your head de dia jhoor. You no get problem ooo . omoge wey get sense. Solomon descendant. You don do well
We even plenty wey no see pocket money but really it wasn't easy at all o, shuffling study and hustle together.
Ajeh all legit hustlers gat make am by God grace because it wasn't easy one bit plus make you still come get responsibility join, the self-starving no be for here but it was worth it in the end.
Biko savings is highly important o, let who that has ear hear
See as sense full one person brain 😊 hehehe
See whining. Ona don start again... Senkiu Baby lolo
When you no be generator, how I go dey whine you 😂😂😂
Wetin De my body pass jarking. I pass generator
Boss of the bosses, this your pidgin sweet me o.
Your points are absolutely valid 💯
Hehe... Me wey still be learner. Ogbeni no whyne me
Learner pass learner
Okay o, boss of the learners 😂 😂 😂
Haha... Your matter still de screening
Biko panel of judges, reason the matter very well
We still de reason am.