You are viewing a single comment's thread from:

RE: Hive-Naija Weekend Engagement #46 - "My Dream Job"

in Speak Peace β€’ 2 years ago

I don land with my entry oo πŸ˜‰ after I don Waka read plenty entry.... nawaoo, see how so many dreams scattered everywhere.... people dey find anything to earn a living, it is well

What is your dream Job?

My dream job was to work as a medical lab scientist oo where I go dey diagnose people's ailment. I have admired that profession from afar but jamb jam me just like @merit.ahama said πŸ˜‚πŸ˜‚...infact my last attempt, my people na only one mark Dem take cut me off πŸ˜‚πŸ€¦....I come vex put dental technology oo....na there I come found another dream job but no be my original dream but I come wake up to dentistry...lol

Are you currently at it or are you doing something else?

I no dey for it my people....it only became a dream but never turned to reality πŸ˜‚

Is your dream job achievable or not.

Well, I no go lie oo... going back to school after 3 children here in Nigeria is not a joke 🀣...I don't think it's achieveable anymore.. make I just dey blog my blog dey do my dental technology job small small...las las, na money be the koko

@quduus1 , @justfavour, no violence today oo πŸ˜‚....thank God say na cool topic
I come in peace πŸ•ŠοΈπŸ•ŠοΈπŸ•ŠοΈπŸ•ŠοΈ

Sort: Β 

Hehe.. No vawulence.

Nkem, your dream is still achievable na.. Just go back to school and start receiving lectures like us. Don't worry engr will take care of the kids.

πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚
Favourrrrrrr....don't let me catch you there
Abeg...I no get strength for seminar, term paper, quiz...exams, project...name them
I jump and pass πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ€£πŸ€£πŸ€£πŸ€£

Ahhh abi you no Sabi book again lolz πŸ˜‚πŸ€£ confess lol 🀣🀣

Hahaha πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚
I Sabi book pass you
Shift abeg πŸ˜‚

Ahhh you no no weytin you dey talk lol 🀣🀣🀣

Ahhh see this one saying mtchew 😏😏😏😏 which school..
Na engr wan take care of my breastfeeding baby lolz πŸ˜‚πŸ€£πŸ€£

Hahaha 🀣🀣🀣🀣
Lmao

Lolz πŸ˜‚πŸ€£πŸ€£ you no talk you dey laff

Hmmmm don't angry me please πŸ₯ΊπŸ₯Ί na you start tagging oh and I go give u back to back lolz πŸ˜‚πŸ€£...
Una no read for JAMB lol 🀣🀣🀣 why he jam Yu lolz πŸ˜‚πŸ€£...

I am rooting for u to go back to school after 3 lolz πŸ˜‚πŸ€£ se you go still Sabi book like this lolz πŸ˜‚πŸ€£πŸ€£

Your head πŸ˜‚
No be me and you go go back to school...unread me now abeg πŸ˜‚πŸ˜‚

Ahhh okay by the time I am done with you, you will be okay lol 🀣🀣🀣

Hmmmm
Fox...the last time I checked, I didn't wrong you so free me πŸ˜‚πŸ˜‚

Ahhhh lolz πŸ˜‚πŸ€£ you don enter my red book lol 🀣🀣 🀣🀣🀣

I erase my name in Jesus name...oya say Amen

Lolz πŸ˜‚πŸ€£ amen lolz πŸ˜‚πŸ€£ but we still dey lolz πŸ˜‚πŸ€£

πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

So na our two JAMB jam so... Nice one, I'm proud of you.
At least, you still dey close to the line πŸ˜‚

Na money be the koko o
If the dream job nor come, we turn the job wey dey available to dream job

No stress πŸ˜‚

Hahaha 🀣🀣🀣🀣
You Gerrit merit
Na to turn any available job to dream job..full.....stop!!!
Lolz πŸ˜‚

Eggzactly πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

πŸ₯šπŸ₯š xactly my Merritt πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ‘

Hahaha this my ambassador don start oo, e pain me say I nor fit come read this your answer since, lolz. Well no vawulence so I go go easy, hehe.

Dentistry is not bad at all and you don still be blogger, better one for that matter so you nor get problem at all, hehe.

E pain me pass say you no see my entry
But no wahala shaa πŸ˜‚
Dentistry is not bad atalll....the blogging part come join am, better combo
Lol

Nor mind me jhare, I just forget to come back but now when I wan do post summary I gat go read everybody entries, as I see your own I come gat comment.

Keep grinding your blogging biko, hehe.

Happy landing Ma πŸ˜‚

Lolz
Thanks Sam πŸ˜‡