You are viewing a single comment's thread from:

RE: OUR GOVERNMENT TRY WITH NYSC?

in #naijapidgin7 years ago

E dey give youths wetin dem dey call work experience, and if the youths do the wey dey give them for their * Place of Assignment*, dem fit retain them and then unemployment don end for the person.

Taaarh! Taaarh again!
Which kain work experience?
Who dem wan retain?

NYSC wey go transfer a whole engineer go teach for one village for north. Shey the guy go con add teaching to him work experience?

Abi na village wey no dey pay teachers pass #8000 you go pray for retainment?

That's why people wan dey town and them no wan serve for school. 80% of corpers, na schools dem post them. And the school na yeye school self.

NYSC na waste of one year. The money con small. When I serve, the 19800 dey finish in three weeks.

Sort:  

@afolwalex, baba mi, no talk like that, nysc no be waste of one year for everybody, but na waste for many people wey no use their one year proportionally.

nysc get purpose, and the purpose na to create experience, wetin I mean by experience here to me no be for work o, because me no be kind person wey dey work for person, the experience here na to meet other tribes, languages, cultures and tradition, meet new environment, new business partners and learn from them, some people dey wey study all their 6-3-3-4 system of education for one state, e no good like this, travelling they say na part of education, person wey travel go plenty places no feet be the same with person wey no travel at all.

so 1 year nysc to me no be waste, na awa youth dey waste am for theirselve