Naija pidgin good morning oo
How the weather dey for your side?
I hear say rain don dey fall, but the thing no gree reach Kaduna..
We don carry another ogbonge tori wey concern our youths and our future come again.
Federal Government don release thousands of youth from National Youth Service Corps (NYSC) again yesterday
NYSC good o.. E dey help people mix with other tribe, come know there culture.
E dey give youths wetin dem dey call work experience, and if the youths do the wey dey give them for their * Place of Assignment*, dem fit retain them and then unemployment don end for the person. But wetin dey pain me be say our youths dey always miss this opportunity, because dem no dey take their service year serious, most of them be ghost workers, most of dem no dey go work because e fit be say their PPA no dey pay, but dem forget say they fit meet their helper there, or the organisation fit retain them. Most of them dey run from the state wey government carry dem go, but dey no know if na that place their own gold mine dey, No be everybody go make am for city..
Una know say unemployement na one of the biggest issue wey we get for this countri
As the youths dey jolly yesterday, I come dey wonder wetin dem go do next?
How many Companies go give all these people work?
How dey go take survive without that little allawee wey dey enter?
Naija pidgin how una see this NYSC scheme, una feel say our government try give us this scheme?
If you feel say dem no try, wetin make you think so?
Make una begin chook mouth for this matter
Congratulations to myself @nmalove, I follow for the people wey finish NYSC yesterday..
Na @nmalove carry this matter come
na @mittymartz design this ogbonge avatar
@naijapidgin abeg watin be retain for pidgin
Tell us we dey hear
🤣🤣
Guy, no scatter Naijapidgin head this morning. Retain na retain. 😁
'retain' nah "holam down" for pidgin...😀
I hail again oooooo
Dem no try at all. The scheme na scam. 19,800 wey dey finish under 1 week. E no good. Make dem empower dem with atleast 200k to do business as job no dey
E dey, still favour some people sha.. E still get our youths wey go still chop the 200k, dem no go do anything.. e better to use any opportunity wey we get for this life better our life.
Congratulations @nmalove... I dey Happy for you o.
NYSC... Hmmm, na waste of 1year joor, the only good thing be say, you get to meet people and learn a new culture.
Thank you oo @jeline
True talk, you fit meet people wey go connect you, dis our countri na connection countri
Nysc na complete waste of time
Government no try anything
Na to releaese anoda set of jobless youths again
Them no do anythng
Lol, make our youths begin learn how dem go dey use any opportunity wey government give them, so that joblessness go reduce..
I trowey salute o
I congratulate all the people wey do POP yesterday.
work no fit just come instanta for everybody.
my own be say, our government suppose to the maintain the allawee for anybody wey serve the country for some years after the service. So that the youth dem no go dey stranded wey fit make them chuk hand for bad tin.
my people Na my opinion for this matta b dis
@metadonis, if government come maintain am for you, weting comebe the proof say you go school?
if at all you go school, na that time you go apply your brain for the money wey them go give you now.
Which brain you wan apply for 19,800.
you think say Na everybody get people wey the feed them?
read my post well. I say make them maintain for sometime, so that person fit stand ground small.
Bros,average Nigerian youth no fit the proud of earn $5 a day.
my dear, one man's waste is another man's wealth, am not supporting the 19800, but many people can still get something out of it, they are some families in this nation that earns that amount and they still safe and live comfortably.
it's not about how far but how well dear, wisdom and GODS blessing is the key here
Taaarh! Taaarh again!
Which kain work experience?
Who dem wan retain?
NYSC wey go transfer a whole engineer go teach for one village for north. Shey the guy go con add teaching to him work experience?
Abi na village wey no dey pay teachers pass #8000 you go pray for retainment?
That's why people wan dey town and them no wan serve for school. 80% of corpers, na schools dem post them. And the school na yeye school self.
NYSC na waste of one year. The money con small. When I serve, the 19800 dey finish in three weeks.
@afolwalex, baba mi, no talk like that, nysc no be waste of one year for everybody, but na waste for many people wey no use their one year proportionally.
nysc get purpose, and the purpose na to create experience, wetin I mean by experience here to me no be for work o, because me no be kind person wey dey work for person, the experience here na to meet other tribes, languages, cultures and tradition, meet new environment, new business partners and learn from them, some people dey wey study all their 6-3-3-4 system of education for one state, e no good like this, travelling they say na part of education, person wey travel go plenty places no feet be the same with person wey no travel at all.
so 1 year nysc to me no be waste, na awa youth dey waste am for theirselve
Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!
NYSC get him good and bad side. The advantage still pass the disadvantages. Many people don get luck Dem retain Dem for their PPA.some marry some get plenty connection. Although my own time I no enjoy am o but I believe say government dey try with nysc.
I no too know things about this nysc oo but wetin i know be say, as they don finish to dey serve now, the ones wey get mouth among them fit see job do, but the rest ehnn na only God fit help their destiny as companies and industries them no they gree to fire their old workers wey don tey for their side.
If them no do that one tell me where the new ones one work
Congratulations jare nmalove