You are viewing a single comment's thread from:

RE: WHICH WAY NIGERIA?

in #naijapidgin7 years ago

You yarn well oo. Nah the thing wey dey ground you just speak gbowan.

The problem wey jungle justice get be say people wey first do am nothing happen to them. Nah wetin make other come dey do there own.

This our country don turn a country wey you fit do any how come go free.
No be our president look us wey be youth come talk say we dey lazy. You come enter road do protest finish wetin happen. He no come say make we forgive am wetin he talk.

If say person carry the talk go up, una go look for the person. Everyone come dey online

I go just yan only this matter oo because nah him dey pain me pass leave the other matter for other people.

If jungle justice go stop our leaders make them stop am. And people like the police go fit enforce am. Because nah this police them dey still use do the jungle justice. If them do am finish who go come arrest them.

I don talk my own oo as it dey do me

Sort:  

Gbam. you don talk am finish. Na because them go do nobody go do anything about am na make we Nigerians feel say person life dey we hand to put tire for him neck burn am when we like.

Why e be say we no dey use dis jungle justice for our thief thief politicians.? Most times na people wey commit small offence na im dey suffer am pass.

Nah the thing wey dey pain me