WHICH WAY NIGERIA?

in #naijapidgin7 years ago

My country people, una good morning. Today na April 26th, 2018. No surprise say I dey tell una date o. I know say most of us no dey Sabi date again even some day forget the days of the week. Make I still remind una say today na Thursday. Small time we go enter weekend and the month go finish.

Anyway make I no use too much talk start this morning. Today, the matter wey I go like make we discuss na the one wey concern is as Nigerians. During the week, e get two events we happen wey make me siddon come dey reason say, which way Nigeria?
image
The first one be say I dey inside bus dey go somewhere when I see one taxi knock on fine boy we stand for road dey on him own jeje. This boy land for ground come hit him head na so blood begin dey flow like water. You know wetin surprise me? People just gather am, some dey snap picture, some fold hand, some just dey shout and some dey cry while the poor boy dey for ground dey kpeme small small. My country people, no be dey suppose find motto rush am sharp sharp go hospital?

Another one wey happen during the same week na where one policemen don go drink high finish na so kasala come burst between him and some guys wey Dem dey beer parlour together. Before person go say mama mia na so policeman cork gun burst one of the guy's Dem head. Youths Dem come because come gather this policeman come dey Lynch am.

All these things come say make I ask una my country people,

1. Why naija people dey find am hard to carry accident victim go hospital?
2. Jungle justice, na the best way to handle mater?
E dey important make I hear wetin una get to yarn on top this Tori wey @zizymena carry come una domot.

We still get WhatsApp group where every every dey happen. If you never join abeg click here
image
Na @mittymartz design this avatar for us.

Sort:  

You yarn well oo. Nah the thing wey dey ground you just speak gbowan.

The problem wey jungle justice get be say people wey first do am nothing happen to them. Nah wetin make other come dey do there own.

This our country don turn a country wey you fit do any how come go free.
No be our president look us wey be youth come talk say we dey lazy. You come enter road do protest finish wetin happen. He no come say make we forgive am wetin he talk.

If say person carry the talk go up, una go look for the person. Everyone come dey online

I go just yan only this matter oo because nah him dey pain me pass leave the other matter for other people.

If jungle justice go stop our leaders make them stop am. And people like the police go fit enforce am. Because nah this police them dey still use do the jungle justice. If them do am finish who go come arrest them.

I don talk my own oo as it dey do me

Gbam. you don talk am finish. Na because them go do nobody go do anything about am na make we Nigerians feel say person life dey we hand to put tire for him neck burn am when we like.

Why e be say we no dey use dis jungle justice for our thief thief politicians.? Most times na people wey commit small offence na im dey suffer am pass.

Nah the thing wey dey pain me

I n just understand naija at all
They see say person dey die they carry phone dey snap am photo people no just wan receive sense the best thing na to rush am go hospital make e recsive treatment na
Then police go take beer e con dey fire person na to lock am up for jail make e get sense back na be like the economy of the country don dey make some persons kolo
Naijapidgin make una carry go

The mater just tire person my sister.

You yarn am well my baby

my own take on the first mata be say, for we country so we don hear of many experience whe be say pesin help accident victim con put imsef for trouble lyk make the pesin die b4 dem reach hospital and police wahala...but dat one no suppose stop us from doing good sha
una well done

This police wahala sef. Why police people dey make matter hard for common man for this country. You help person na wahala again. I hear say dem go dey ask you many many questions.na true?

na true yarn oo...dem fit implicate pesin sef

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

My country pipu, how una dey?
Make I shook mouth small for today Matta.
On top the first matta, me I feel say na fear they make most naija pipu dey abandon person when get accident for road o. On to say, if dem rush the person go hospital, doctor go ask for police report and some kind tins, before e go gree treat the person. Sometimes, before dem go get d police report come back, the person when get accident fit don kpeme! And that one na biggggg wahala!
So instead when person go die for their neck, naija pipu ready to fold hand dey look d person when get accident for road dey die. Ha! Provision store beta pass kiosk o.
My country pipu.
Na only God go help us for dis our naija.
Una do o.

Wetin you fit say government fit do make these wahala of police report stop?

Just like the country dey red na so people dey bleed follow am oo, as for accident i don see case were person help rush accident victim go hospital oo, na so b4 dem reach d man just die, lik play lik play police don arrest the person wey try help oo at the end 5k drop b4 dem gree release am,
Dat kin tin nai dey mak most peopl turn observers especially when somtin lik dat happen sha, even the police people self fit come the scene just 2arrest the people way witness the tin.

Na wa, na im be say government suppose talk to this police people make Dem no dey do like this now so naija person wey get good heart go fit help others.

Omo people dy fear for we country because you fit how put mouth help pesin and you go enter give with police people.

Concerning that police shooting, Omo na everywhere...

E just weak for the matter.
E no dy encouraging atol

So na which way d country dey go so?

People don dey misuse social media.. Everybody dey rush carry news, na wetin make dem dey snap picture like dat, no conscience at all..
Jungle justice no good at all, may innocent people don die like dat. But make naija use the jingle on top politicians, i go happy..

well for my side,jungle justice no be the best way to settle yawa at all,infact na him worst pass,english people don talk am say make we no dey take matter into our hands,anything wey happen make we sharply report am to oga police,jungle justice no be the solution at all because even atimes the person no go dey guilty,they go just kill innocent people,the thing wey good pass na to carry matter give them oga police

Ahhh naijapidgin this Una yarn touch me no be small
Sometimes Ehnn I no even understand some humans again

This matter na strong one o...na why we dey advocate for love so dat u no go see ur broda dey kpeme come dey snap...
The police suppose coole we community na em come dey shoot gun after shayo.
I tire o.
But me no go taya to dey believe say we country go better becos na we get am na we dey here
@naijapidgin i throwey nyash for una...una wehdone