Chai! Ogbonge witch... I carry yansh for you baba. That place go bubble no be small. @funmiakinpelu go order babes enter. Asun and shayo go dey flow like water... Better whine go dey for one corner, smokes sef go dey for us wey be agberos. Baba Gentle go con sidon on top correct chair dey smile as him pikins dey enjoy shayo. Shey you know say na Alfa him be...
@synick carry East palmy come Lagos yesterday sef. Today na for correct shayo baba...
About that plane, baba no be sea plane na 😂
Ah don die. Shayo go dey for inside meet up? Na chemical shaa, ein na part of STEM shaa.
Wait oo, palmy dey ground? Kuku kee me naa.
Baba Gentle go take cassava branch pursue una comot. Who go bring zobo come naa? Dat one na Rarphael shaa.
But baba ee, after every every, u na confam agbero oo. But which kind weed go dey? Na dried paw paw leaf u go smoke?
Omo dis meet up go make brain die, ah swear..
Well, I go join for inside spirit shaa.
Notin do una
Hehehe... We be Science students after all. 😂 😂