You are viewing a single comment's thread from:

RE: Hive-Naija Weekend Engagement #51 - "CONNECTION"

in Speak Peace β€’ 2 years ago

Breeze don blow me come here this week, make anybody nor ask why I dey absent since sha... No words to clear the story πŸ₯²

How ona dey my people?! I miss ona sha but as I dey type this thing now, I realize say I nor really miss ona 😏

You pipo will just be everywhere on Hive mentioning and checking on me anyhow πŸ˜’πŸ₯°πŸ€­ ona too much joor

Okay, to the questions πŸ™„

IS CONNECTION IMPORTANT?

Very important... Both here on Hive to grow your post rewards by having rich connections, and in real life parties where it seems there's no way to get served food πŸ₯² connection is very important in exam hall too, if you know you know πŸšΆβ€β™€οΈ

WHAT HAVE YOU BENEFITTED FROM HAVING A CONNECTION?

I've once bought a dress cheaper because I know a friend who knows the seller 😁 the sweet me ehn... The difference in amount was so much. Get plenty friends, e get why.

Get friends for buying things, for employment, for party and many for Hive... You gerrit? 🀣🀣

Sort: Β 
Β 2 years agoΒ (edited)Β 

Lolz πŸ˜‚ 🀣 🀣 🀣 🀣 connection na big deal for real life oh lol 🀣 🀣 the connection wey I wan get now lol Na soldier connection lol 🀣 🀣 🀣 🀣so them go fit help me bundle you well lol 🀣 🀣 🀣 🀣 hehheh I love party connection tooπŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚ that party connection dey sweet die Lol 🀣🀣🀣🀣🀣 you go chop over load Lol 🀣🀣🀣🀣 them go give you go house self lol 🀣

πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚
See as you just dey plan evil wey you wan use your connection do, bundle me? That connection shall never come πŸ™„

Party connection make sense gon πŸ₯°πŸ˜‚

E never get the connect, e don dey strategies πŸ˜‚

I tire o πŸ˜‚

Every connection matters 😊

Na hive and business connect dey hungry me pass now πŸ˜‚

Na that Soldier connection I need right now, make I go bundle the tailor that refused to sew my husband and his best man wedding suits

Awnnnnn when is the wedding????

September this year and until now we never collect am πŸ˜‚ had to buy a new suit 4 days to the wedding

awnnnnn congratulations,God bless your new home dear, i think we need to arrest the man swears lolx

Thank you, Amen
Yeah, that's why I need a connect

Did you miss meπŸ˜‚πŸ˜‚, don't break my heart by saying noπŸ˜‚

chaii, see foodie people in the house, that's true sha, If you're going to party, just make sure you sabi person, without ham, e no certain say you go get food. that's why I no dey part wey dem no call me....e no go good make i go party make i no chop.. that's bad luck πŸ˜‚πŸ˜‚

Everything wey dey happen for this naija need connection. if not, Oyo(on your own).

Ask me again next year, I fit miss you next year πŸ₯²

I know how many time I don go party nor chop, e pain me ehn πŸ˜‚ so I dey make sure say I know who get party or at least get strong hand for the food department 😁

Normally, na connection get Nigeria 😏

Ask me again next year, I fit miss you next year πŸ₯²

I no go just talk 😏, somebody broke my heart this early morning πŸ™ƒ

That kind thing dey pain persin , for where you no see food chop, na there you go still see some people we go still carry take away go house after eating...this country nah comedy πŸ˜‚

I thought you would need breakfast so I served you one πŸ₯°

Lol... As in ehn, some go even carry up to five for inside their bag

I thought you would need breakfast so I served you one πŸ₯°

don't be mean nahnnn, be nice sometimes πŸ˜€.

Those people carrying up to 5 are trying, they are legends of the party...

πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚
I have already become mean, I will try to change sha

Becoming a legend of party is something I don't think I can be, I wish I can πŸ₯²πŸ˜‚

Yeah, try to be nice... especially to me , I don't mind if you're mean to @moremoney28 πŸ˜‚πŸ˜‚(somebody will bite off my ear today)

Well, me too, I'm a very shy type in a party, I don't know how to fight for food , talk more of taking extral home

πŸ˜‚

Party rocker πŸ’―

No be small thing ooo

This breakfast too choke πŸ˜‚

You never experience where dem go still dey pour inside nylon

As in ehn... I don see that one tire πŸ˜‚ I know person wey good for that thing gon

Some people na drama queen and king πŸ˜‚

πŸ˜‚ πŸ˜‚ πŸ˜‚
Person wan go hospital sef, you need connect πŸ˜‚

That party stuff they pain person o πŸ˜‚ if you come buy cloth join πŸ˜‚

In Nigeria after connection, na still connection πŸ˜‚

🀣🀣🀣
How person go buy cloth wear go party, he nor go even see water drink because he nor know person wey know person πŸ₯²

E too choke πŸ˜‚ πŸ˜‚ πŸ˜‚

Na why I no dey do extra extra for any party wey I no get better source.

If dem carry everything pass you, e go come be like say you too over do for where dem no recognize you (My thinking though)

Na valid thinking joor
Na to dey moderate when you nor know person wey know person πŸ˜‚

Abi o πŸ˜‚ make dem no dey carry person catch cruise

Na why me sef no dey go party or any gathering wey dey no invite me.

I go one Church for program last month sef, na eye dem dey take give all this daily manual guide for morning devotion.

Shay wahala no too much laidis πŸ˜‚

abi nah .. everywhere is Connection, but that shouldn't happen in the house of God sha.

Na so I see am that day

@merit.ahama howfar dear should we start our early morning violence πŸ˜‚ meanwhile I've connections oo but come to Lagos for the connect big head πŸ˜‚

The big head nor gree size bus go Lagos o
I for come for my share of the connection wey you get 😏

LoLs πŸ˜‚ come Lagos come collect connection o πŸ˜‚

I'm not coming o
I'm very sure the connection has a lot to do with beating πŸ₯²

You always knows my next movement πŸ˜‚ if u like run from today till tomorrow you will meet me for camp

🀣🀣🀣
Because of you, I will post pone my country serving matter... We serve next three years after Moremoney is done and working somewhere already πŸ€ͺ

Anywhere you like make you go πŸ˜‚ I'm coming for you

People way like awoof .

But last last connection good oo..
Even song say follow who know road .
If you mistakenly sabbi who dey share food for occasion,omg that day don stew for youπŸ˜…πŸ˜…πŸ˜…πŸ€£πŸ€£

πŸ˜‚πŸ˜‚
As in ehn... The matter different if you know person wey know person πŸ˜…

🀣🀣🀣🀣🀣asinnnnn

Wey come know another person at the top πŸ˜‚

πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚
Eggzactly

Wahala no come too much laidis πŸ˜‚

E don tay wey wahala too much na πŸ˜‚

πŸ˜‚ πŸ˜‚ πŸ˜‚
E just dey reach my side o

E don over stew sef πŸ˜‚ na cruise remain

🀣🀣🀣🀣I say eh

Facts πŸ’―βœŒ

Connection is absolutely everything and all it takes for growth 😊

Hehe yes o

Β 2 years agoΒ (edited)Β 

You sef sha don experience connection normally πŸ™‚. Na people like you we go come meet to give us connection advice, lolz.

πŸ™„πŸ™„
What is she saying?

What you don't need to understand, if you don't Gerrit forget abborit 😁

Oya shift πŸ™„

Hahaha, come and carry me and shift nau 😜